GOSPEL WEY JON RITE 1 How God Word Com Mit Us 1-From wen taim - TopicsExpress



          

GOSPEL WEY JON RITE 1 How God Word Com Mit Us 1-From wen taim bigin na im di word dey, and di word dey wit God, and God kpa kpa Imsef na im bi di word. 2-Di word dey wit God from wen taim bigin. 3-Na im make everitin and if no bi sey na in make dem, dem for nor dey for dis world. 4-Na im bi life and dat life na im bi di lite wey pipol get. 5-Di lite dey shine for darkness but darkness no gri wit Am. 6-One man wey God send kon com, E name na John. 7-E com bear witness for di lite, make everi persin get di chance to take biliv wetin God tok tru Am. 8-Nor bi John imsef bi di lite, but e com tok to pipol about di lite. 9-Di tru lite wey go giv lite to everibodi go com for dis world. 10-E dey inside di world wey En Imsef make but di pipol no sabi Am. 11-E com mit En own pipol but dem say dem nor want Am. 12-but everi persin wey receive Am di pipol wey biliv for in name, E giv dem di right to bi God pikin. 13-Dem go bi God pikin nor bi as dem mama and papa born dem from belle or bicos somebodi make dem so, but bicos God Imsef na im make dem En own pikin. 14-Den di word com bicom persin and kon stay wit us for dis world. We kon si En glory wey bi sey na Em bi di only persin wey get correct favor and trut, wey God send com mit us. 15-Wen Jon bigin tok of Am, e kon dey shout, sey, “Dis na di persin wey I tel una about, wey I tok sey “Di persin wey go com afta mi big pass mi, bicos E dey bifor mi. 16-We all wey dey for dis world don receive one beta tin or anoda from En hand. 17-Na tru Mosis God giv us di law but God kon bring correct favor and trut to us tru Jisos Christ. 18-No persin don fit si God bifor. But Jisos Christ wey E bi dey God Imsef, wey en and di Papa bi di closest padi, na im show us how God bi.
Posted on: Sun, 07 Jul 2013 08:39:08 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015