God dey (copied) Wen man wey im family nor dey make newspaper - TopicsExpress



          

God dey (copied) Wen man wey im family nor dey make newspaper headlines even if dem get money wan marry daughter of man wey get money and always dey paper, make una see how the headline dey be; Dangote gives out daughter in marriage. (Where the boy or im family name for the headline?) Now, even if newspapers put the young man name, see how dem dey write am; Bayo (not real names)marries Oba of Benin daughter. (Who be Bayo?) See another example; Large turn out as Mike Adenuga gives out first daughter. Wait o, na Adenuga dey give out im pikin o, abi? To who na? Let us try a soft sell headline; Big boys, President Jonathan storm Lagos as Otedola gives out daughter. (Who Otedola dauta marry? You nor go no until you read the main story. It shows say the boy papa name nor go fit sell the magazine). Press people, God is watching una o. See the kain headline when follow Jona dauta marriage; President Jonathans daughter weds Abuja in lock down as Jonathans daughter marries I dont want my daughter to leave me, but, says Jonathan (Dem nor dey interview the boy papa?) Okay, even if dem interview the boy papa, make una see the headline; I am so happy, says father of boy that married Jonathans daughter. It is not FAIR, but God dey. So my wish for you reading this is: If you never marry, God go make you hama now na b4 you marry. If you don marry and you never hama, God go make you hama b4 your boy pikin wan go marry another influential person pikin make the headline read: Fredericks son marries Adenugas daughter. Or, Why I agreed for my son to marry Otedolas daughter, says father of groom. God dey!
Posted on: Thu, 19 Jun 2014 20:08:13 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015