Good morning to you all my fans. Today I hav a latest news from - TopicsExpress



          

Good morning to you all my fans. Today I hav a latest news from the Animal Kingdom. Mr. Ufa Dizz, de monkey wey get mouth well well for de Monkey Association Of Africa (MAAf) yesterday come yarn Amebo pipu (the press; news men) about de reason y their association come bring Ebola into Naija in de lass 2months. De guyman say, na weytin de Bokoharams do in kollabo with some Nigerian politicians for hin pipu inside Sambisa forest na hin make him tell his pipu make they teach Nigeria her unlearned lessons. De guyman get vexed as he dey yarn pipu on top de matta wey dey happen for hand right now in Sambisa and other places like Gwoza, Madagali, Gulak, Michika and de ress. He further said that, b4 this BH matta, Sambisa forest has been a place for all kinds of animals especiali de Monkeys an de Bats bot as of now, dey don chop finnish some of our pipu an some like mysef come run sitdown for Cameroon as a refugee. I asked de guyman whether na from where they come get de Ebola virus come smogle it into Naija without de Nigerias Custom Service an de Navy knowing it. he said you pipu talk say because we keep quite inside de Jungle we no fit do anytin ko? Hmm, na kollabo we come do with one of de top countries in world wich I will not mention its name. Our association asked them to helep us with smol amount of de virus wich dey produce in order to destroy de world with it make we teach Nigerian politicians some hot lessons they never learn from de Whiteman. Na so dem carry small give us.
Posted on: Mon, 15 Sep 2014 09:45:34 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015