HAPPY BIRTHDAY TO THE MAN WEN SABI. Oya we all for the studio - TopicsExpress



          

HAPPY BIRTHDAY TO THE MAN WEN SABI. Oya we all for the studio wey dey Okoloko bridge for throway red carpet of DIVINE FAVOUR today for ground as we raise all our hands up dey wish dis persons HAPPY BIRTHDAY; * Ebosa Johannsson. * Ebosa Joseph. This two children names na from the most successful business family wey Sapele don ever produce and dem nor be twins but them born dem two dsame day for different years. To crown it all their Papa wey be; Hon. Chief,Prof,Engr GODWIN EBOSA Gcfr of Warri North. The Iroko of Oil Vessels. The Ogbolor1 Of ABUDANCE BLESSINGS. The Director General of Awaritse Nig Ltd. The Director General Of Ocean Explorers Nig Ltd. The Oga kpatakpata of Coastal Consults Ltd na also PLUS (+) ONE today. Dis na the first time wey we dey celebrate 3people from one family for this page and na God Power nai do am. WE rub unu three body with Otaiko and Erigheje of LONG LIFE. I throway acid of GOOD HEALTH for unu body. I bath unu with river ethiope water of LAUGHTER. All unu enemies go sleep wake up for SAMBISA FOREST. Anybody wey plan bad to unu go catch EBOLA kpajeje. As we dey pray so na so we wish all ourselves wey go wish join SAPELE TAFIA wish unu HAPPY BIRTHDAY the blessings wey God don use bless unu. Today nai unu three clock plus one and na today nai unu go see sickness lass. I throway Governor Emmanuel Uduaghan,Hon. Micheal Diden, Ayiri Emami,Thomas, Hon. Pa Thomas. Hon. Monday Igbuya. Hon. Austine Ayemidejor. Chief Charles Obule. Mr Augustus Erebor and All oil gurus for plate take wage Kola for you and make the kola nor roll,i use SOLOMON ABEKE. FRANCIS MAKU. CHURCHILL AMEDU. SAMSON ABEL AND STANLEY MAKA take wage the kola and any attempt d kola take roll i use my one eye and two seedy take dash u d kola becos ur name big like namanama shit. Oya make unu join me hala HAPPY BIRTHDAY to this great Family. Hip Hip Hip.........HURRAY. Courtsey: HSE BENEFICIARIES and TONY ANIRETAN.
Posted on: Wed, 30 Jul 2014 12:34:13 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015