HIP HIP HIP HURRY ! HIP HIP HIP HURRY ! HIP HIP HIP HURRY - TopicsExpress



          

HIP HIP HIP HURRY ! HIP HIP HIP HURRY ! HIP HIP HIP HURRY ! Na God Divine Paley Soda wey dem mix wit d SHOWERS of LONG LIFE nai we take sama dis ur head today. Dear KPEZI ORORO ANDY, from our studio na we take hold trumpet take sing beta Happy Birthday Song to u. We use Divine BREAKTHROUGH take paint ur face as we apply the bleaching tube of PROSPERITY for ur skin. We use the milk of FAVOUR take mix ur tea of HAPPINESS today. We use the groundnut oil of JOY take fry ur egg of PROMOTION today. We use the water of GOODLUCK take mix ur garri of RICHES today. Na Ambulance nai all ur enemies go dey sleep put. U go shine like shooting star. U go excel for life and u go wack d fruit of ur LABOUR sam-sam we use Paulash Asemota, James Ibori, Atete Sagay,lucky Ayomanor, Igbuya,Austin Ayemidejor,Fracis Maku and my boy Atose take wage kola nut for u. I still support d kola as usual with Solo Abeke and Jolomi boyo blokos. MESSAGE COURTESY From Tafia Crew.
Posted on: Mon, 29 Sep 2014 16:01:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015