HOW TO MESS IN PUBLIC & RETAIN UR IMAGE. To mess for public dey - TopicsExpress



          

HOW TO MESS IN PUBLIC & RETAIN UR IMAGE. To mess for public dey sweet but if dem catch u, no be small embarrassment o! Just follow dis guidelines & u are on ur way to being a star in dis profession. 1. Wen u enter a hall, check d wind direction,if na closed hall wit air condition or fan,beta 4 u. Maximum impact. 2. Make sure say u sidon face d wind direction.... 3. Make sure say u get enof leg space. U go soon knw why! 4. Form ajebo by crossin ur legs every now&then. 5. U don ready 2 execute, try hold am until time wey d hall dey noisy incase ur mess na d type wey dey sound like AK47. 6. Now carefuly cross ur leg, right over left. 7. Elevate d right yansh. 8. Release small (sound check) 9. If no sound, allow make d mess flow steady. 10. Allow time 4 proper circulation. NOTE: 1. Make sure say no be u be d first person to complain. 2. Wen pple begin dey shout Jesus who do dis wan. E no go better for d person wey do diskind thin, simply ask why som persons no fit respect demselves 4 public places?na wa o 3. No shout pass odas if not u go become suspect. 4. Take style disengage from d area, relocate to another zone and repeat d exercise! Trust me,u will go places wit dis profession.d world must hear of u more dan Micheal Jackson..
Posted on: Fri, 09 Jan 2015 21:18:55 +0000

Trending Topics



ight:30px;">
I know the official explanation for the Walter Pyramid on CSULBs
Absolutely amazing! Beauty of Mathematics !!!!!!! 1 x 8 + 1 =
Lucky day exploring and finding these beautiful flowers when

Recently Viewed Topics




© 2015