Hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha - TopicsExpress



          

Hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha hahaha my people how una dey. Today i sey make i comot go for one restaurant like that go eat with one of my guy like that, as we reach there na, we come sidon for chair. Na im wey i tell my freind say make e oda for something na. Him come talk say make i oda first as somebody wey no dey like to dey form americana naw, i tell the waiter make e arrange correct eba with original bitter leaf soup for me lols. Na so I come start to dey hammer this food, na im my guy come dey look me one kind, i come askam sey wetin happen?? Him come tel me say him nor fit to eat eba for this kind place oo. Him come oda for indomie and chicken, omo come see fight for where this guy dey chop. Him no sabi how to use fork and knife. Na so him play with that food soteyyyyyyy i come finish my own food, i come carry tooth pick dey clear the small e know wey dey my teeth dey wait for my guy to finish him food. I come turn back come see one babe as she dey busy dey struggle with her own chicken with fork and knife, she nor fit cuttam. Some people come dey tell her say make she kuku ma carry hand na but she no gree. Na im small time the meat come comot fall for ground oboy come see laf. I laf soteyyyyyyy my bele come block Lmaoo. I come turn see as my guy still dey struggle with him own na, i come telam sey guy give me mek i help you joor, i collect the chicken carry my hand piece the meat come begin to hamaram becos na my money and na me go pay for the food. Na im wey my guy come vex come dey go house. My country people, Na im make wey e no good make una dey form. Make you try be yourself always. Nobody go kill you. Shey una dey feel me??? Lmaoo
Posted on: Tue, 20 Aug 2013 19:05:14 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015