Helele Match Tori: Naija v Iran De las time wey Naija win match - TopicsExpress



          

Helele Match Tori: Naija v Iran De las time wey Naija win match for World Cup, na for 1998, wen de tin bin hapun for France. Now, na Brazil e dey hapun, and Supa Eagus go follow Iran play dia fes match, to cancel all de yama yama of bifor. Naija coachi, Stephen Keshi, don enta book sha, as de fes persin wey play ball for Naija (na hin be skippo dat time sef) for World Cup, come still be coachi for anoda World Cup again. Keshi go dey fin three point well, well, to start Eagus waka for Group F wit win. Iran coachi, Carlos Queiroz, sef, no be small pikin. Hin don be coachi for ogbonge team dem, and na so de bros turn Iran to beta team, wey dey defend faya.De way Iran dey play now, na to defend like army, come carri counter bilala pipu. De tin dey worry. Queiroz (no be bros sef. Na paale bicos hin don reach 61 years) don do coachi work for England, Spain, America, Japan and South Africa, and hin dey carri Iran enta dia fes World Cup since 2006. Na how to kolobi Naija go full dia mind now. OLD MATCH TORI Na onli once Naija and Iran don jam diasef, for senior men futbal. Na one play-play match for Hong Kong, for 1998, wey dem bin call Carlsberg International Tournament. Naija waya dem dat time. Na Ahmed Garba bin score de onli goal, wen match bin reach 50 minit, as Naija kolobi Iran, come join Chile and Hong Kong Eleven sef, carri cup. PIPU WEY PLAY DAT TIME: Naija: William Okpara, Jero Shakpoke, Ganiyu Ajide, Karibe Ojigwe, Kingsley Obiekwu, Uche Okafor, Henry Onwuzuruike, Gabriel Okolosi, Otiji Amaechi, Emmanuel Ebiede, Garba Ahmed. Iran: Ahmadreza Abedsadeh, Mehdi Pashazadeh, Naim Saadavi, Reza Rezaei-Manesh, Mehrdad Minavand, Afshin Peyrovani, Farshad Falahatzadeh, Mehdi Mahdavikia, Hamidreza Estili, Alireza Mansourian, Ali Asghar Modir Roustar. HOW DE TWO CONTRI BE NOW: Naija: D D D L Iran: D D D W TEAM TORI: Naija: Defenda, Elderson Echiejile, don comot bicos of wound, and Ejike Uzoenyi don carri hin jersey. Kenneth Omeruo bin no play, wen USA bilala Supa Eagus, so hin fit start dis match. Iran: Coachi, Carlos Queiroz, belle go sweet am, sake of say hin playas no carri wound. Dia old time skippo, Javad Nekounam, go holo midfild, wit playa wey dem born for Holland, Reza Ghoochannejihad, as strika. WETIN DEM YARN: Mikel (Naija): We sabi say guymen eye go dey ontop out bodi, sake of say na we be Africa Champion. E mean say small headache dey, but out head big. No kin headache fit worry us. Na we be Africa Champion na. Queiroz (Iran): We musto do pass oursef three tines, but na wetin make World Cup sweet. GUYMEN WEY FIT RUN TINS: Naija: Victor Moses: Moses dey tap hin club ball for Chelsea and na hin don show hinsef pass for all de match wey Supa Eagus take prepia for dis World Cup. Moses sabi tia race and na so defenda dem, dey tension wen hin show. Na hin Naija go dey look to helep dem win dis match so. Vincent Enyeama: Enyeama na fes goalie for hin club and for Naija. He keep sotay, dem dash am award as de bes Africa man playa for France League. Enyeama dey catch faya, and e be like say hin no dey fear ball wey dem cross enta 18 again. De tin bin dey worry am bifor. Na hin third World Cup be dis and hin be assistant skippo sef. Iran: Steven Beitashour: Na America dem born am, and e neva too tay since hin start to tap ball for Iran. Na since las October hour fes start to play for dem, but hin na coret defenda. He dey tap as lef or rite back, but de guyman dey like overlap. Hin jus start to play for hin America club, San Jose Earthquakes, since 2010, but hin go use dis World Cup sell hin market. Ashkan Dejagah: Dejagah be like Messi for Iran pipu eye. Hin bin tap beta ball wit Fulham las season, even tho dem still relegate. Dejagah na gree-die midfilda but hin dey like go front go tia net too. Na for hin bodi Iran coachi, Carlos Queiroz, go get hope. TORI WEY DEY ONE KIN: Wen one internet aproko wey dem dey call Yougov ask pipu say; dis 2014 World Cup so, who dem no like pass? Pipu tok say na USA, Argentina and Iran dem hate. See why aproko dey worry? NAIJA TEAM: GOALIE: Vincent Enyeama, Austin Ejide, Chigozie Agbim. DEFENDA: Joseph Yobo, Juwon Oshaniwa, Godfrey Oboabona, Azubuike Egwuekwe, Kenneth Omeruo, Efe Ambrose, Kunle Odunlami. MIDFILDA: John Mikel Obi, Ogenyi Onazi, Ramon Azeez, Michael Uchebo, Reuben Gabriel, Ejike Uzoenyi. STRIKA: Osaze Odemwingie, Ahmed Musa, Shola Ameobi, Emmanuel Emenike, Babatunde Michael, Victor Moses, Uche Nwofor. IRAN TEAM: GOALIE: Daniel Davari, Alireza Haghighi, Rahman Ahmadi. DEFENDA: Hossein Mahini, Steven Beitashour, Pejman Montazeri, Jalal Hosseini, Amir-Hossein Sadeghi, Ahmad Alenemeh, Hashem Beikzadeh, Mehrdad Pouladi. MIDFILDA: Javad Nekounam, Ghasem Hadadifar, Bakhtiar Rahmani, Ehsan Hajsafi, Andranik Teymourian, Reza Haghighi STRIKA: Alireza Jahanbakhsh, Reza Ghoochannejihad, Ashkan Dejagah, Masoud Shojaei, Karim Ansarifard, Khosro Heydari
Posted on: Mon, 16 Jun 2014 09:48:20 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015