Hon Essien buy motor for people them say na Kabu Kabu motor e - TopicsExpress



          

Hon Essien buy motor for people them say na Kabu Kabu motor e buy,E build classrooms,dem say E no paint am well,the roof bend,E give rice, dem say na expired rice, E give scholarship to students dem say na chicken change scholarship,E buy Cloth them say na abomination.. Which Sin Essien Even commit?This man na make us even know say house members they attract development,The man no use constituency money carry girls go flex for abroad,na constituency development na concern am,na that one be e crime?Why Isoko nor even like better thing sef,I really Tire for this Isoko wen I come from oo,If we go see good thing then chase am away,Wait abi na because e dey APC,Okay wetin this PDP don do for Isoko sef,some na die hard PDP members but we nor dey see the benefit of the party for their body.which house member in the history of Isoko south don work reach Essien?.. Okay, I really one know the crime when Essien commit Orezi Esievo wen abandon her people over the years don suddenly become sweet mother.Essien is one of the best thing to happen to Isoko south,And the biggest regret that will befall Isoko South constituency 1 is for them to vote against Essien,they will surely regret it.But since good must Triumph Over evil I see Essien winning again.Orezi has not done enough and as such does not deserve the votes of members of constituency 1. #Enoughsaid
Posted on: Sun, 21 Dec 2014 10:01:13 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015