I MISS IMSU I miss coca cola spot ( wia everybody dey fear if d - TopicsExpress



          

I MISS IMSU I miss coca cola spot ( wia everybody dey fear if d nxt man na frat man lolz) I miss ETF lecture hall, (wia we go dey get lecture students go shoot gun lecturer go folo window and nxt 10min hall wey full go empty.. lolz)) Miss does GingeRing from( edu student). Imsu GIRLS (u dey feed dem,cloth dem, dey take care of dem,,dem live for ur house,bt d girl go still dey cheat on u with alhaji and yahoo boiz #na luv sha).#sobss#evil# I miss EKHONuWA market,.whr babes buy bend down selct dey form ,my aunty sent it from jand fr me#shakng my heed#.. I miss IMSu fronT GATE @ nyt whr u eat roasted fish, plaintain,akara..Etc I miss imsu junction (oburu-puta owa rice) I miss IMSU shrine ( u dey drink palmy and u dey alert cos anything can happen.. not 4 jew mehn) I miss aye and baggers fight( lielie pple 10-0,20-2 yet we no go even c blood 4 ground talk more of 1 deadbody,na 4 sky una dey kill dem? lolz). Indomie spot nko where gals dey com sit down wit dia bb n human hair 4rm 8am till 2pm them go stand up go house.( Them don come school for that day) I miss ORJi pple,wey dey alwys carri bb charger waka up n down.inside skool... miss BISHOP COURT JCtN,whr if u dey pass (u go dn comot ur sim card from ur phone,put am for socks,hold d phone for hand,. miss OPTOMETRY lab where if u dey write exam we dey sit 2 per desk and no turning of neck *****.(Reserve my commnt).i remember nda-leti rice n stew(wey if u come late,u go use ur hand wash ur own plate,mk dem serve u food)kiaaa, i no 4get istanbul (big fufu and 2 big meat. choi!!).....if i continue i no go finish:make i end am here jooor...................i miss IMSU like madttttt joooorrr.... I Rep IMSU
Posted on: Fri, 25 Oct 2013 07:32:08 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015