I luv naija i no go lie.... God bless naija !!!! Na only 4 naija u - TopicsExpress



          

I luv naija i no go lie.... God bless naija !!!! Na only 4 naija u fit win aeroplane by loading 200 MTN recharge card den soon etisalat go say recharge 200 nd win big ship den airtel go come follow say recharge 100 nd win Benin republic ..glo go jst kuku say recharge 500 nd win naija cos green na their colour...na only 4 naija u go see fish 4 meatpie .. Na only 4 naija we dey count money after we don withdraw am frm ATM cos we no even trust d machines.... Na only 4 naija PHCN go say make u win generator if u pay ur light bill.... Na only 4 naija people dey horn 4 traffic light make e quick change frm red 2 green ...na only 4 naija pharmacy dey sell coke,recharge card, chin chin, nd beer ....wetin we no fit see 4 naija u no fit see am any were in d world trust me ...na only 4 naija u go see mechanical engineering wey dey do im NYSC 4 police station... Na only 4 naija u go see a graduate of law dey work as generator repairing ...na 4 only naija u go see advert frm native doctor on how u fit make quick money kia naija una too much jor infact God bless my one nd only kontry........ Naija 4 life ....one love,one nation one Nigeria
Posted on: Sat, 29 Mar 2014 11:54:48 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015