IS IT MY FAULT? On my to church, a call came in my phone, na so - TopicsExpress



          

IS IT MY FAULT? On my to church, a call came in my phone, na so i pick amm ooooh. The man come tell me say he has been seeing my posts on Facebook and he likes my posts he said he has a business for me that would make me rich in a few days, na him i come happy say God don butter my bread. He tell me say he from abuja(a politician) and say he oga go call me soon, they want make i help dem buy a chemical from lagos (cux i dey stay for lag). Him come tell me say the name of the chemical na mayaki say dem dey sell am for d rate of #120k per one gallon, but make i tell he oga say na #150k per one gallon, say na 60 gallons dem won buy and after me and him go come share dat amount wey i top amm (#30k). Mehn...this thing come scatter my head. I come agree fast fast. Na so i come begain to dey calculate the gain,(about #1,800,000) mehn i don hamma, na weytin i come dey tell myself. 10 minutes later na him the oga call me, him come dey beg me say make i help amm to buy the chemical, say the chemical dey very important to his company. Him come ask me how much a gallon costs? Na him i come bolden up, i cleared my throat and cracked my fingers(trust me na)......i tell amm say a gallon go cost #150k. To my greatest surprise, him say he can afford it. Na him my mind come sweet me. Not only dat, he also said he wont be needing 60 gallons again, dat he wants 87 gallons. Mehn see money. Na my own profit na him i come dey calculate wen business neva even click. Na him this man come tell me say make i do amm a favour, make i go collect sample come give amm for airport so that he go see amm. He say he go arrive airport in nothing less Dan 45minutes from dat time. I come agree. I hurry go were dem dey say chemicals and i come ask dem if they get mayaki they directed me were to get it. Mehn..........wen i got there, the chemical man treated me with much respect like say i be king. He come show me the chemical gallons. But him say i have to deposite small money before i go carry one gallon go show the man. Quickly, na so i enter bank, i withdrew the last money wey dey my account(money for my school fees) na so i carry all the #100k wey i withdraw come give the chemical man. Him come give me one gallon of chemical, i come carry amm straight to airport to give the man as sample. Wen i get there, the man neva arrive. Na so i come dey wait till i tire. I call am for phone, him tell me say make i carry the chemical to my house say he no go fit meet up again with me today. I said o.k as i dey carry dis chemical dey go my house, na so i dey protect amm, because they tell me say its highly inflameable. Mehn...wen i reach my house. I kneel down to tell God tank u for making me rich through dis business. I come dey calculate how many land i go buy for my village, which motor i go even buy. I even say i go show does girls wey dey bin form for me dat time. I hide dis chemical under my bed. Small time i no just know weytin enter my head. I come say make i even check how the chemical be. Na him i come open amm. Guess what i saw? My eyes could not believe it......na sand nd water this people carry full dis gallon. I won run mad. Dem don play me. Na so i begain to dey call their numbers, none of their numbers dey go. Na so i rush go back to were i buy the chemical. Mehn..............the chemical man no dey there again. Him too don disappear. This people don really scam me. My school fees is gone. Greed no good ooohhhhh.
Posted on: Fri, 21 Nov 2014 07:18:42 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015