If i tell u say i no dey miss igbariam campus,dat one means no one - TopicsExpress



          

If i tell u say i no dey miss igbariam campus,dat one means no one lie pass me 4 d whole world.. i miss mini mart a market 4 many food joint,, i dey miss okpa nd 7up joint .... chai! Madam leave fufu dey smell die.. i miss green canteen wre u serve ur self,if u com nd sit down waitin 4dem 2 attend u hahaha sori b ur name cos u go wait tire.. i miss staff canteen wre bad boyz drink nd smoke in d presents of dia lecturers.. hmmmm.. i miss those anti cult big chested, if dem catch u urs name na sorri.. i miss ify lodge nd odinaka chukwu lodge, a lodge full of beautiful gals... seriosly i miss seein boys nd gals on black nd white everyday lyk secondry school uniform.. hmm i miss how we use 2 rush nd dive in2 keke after school... lol i miss all dis mascom short damsels, gals depertment.. 4 igbariam i miss english depertment gals dey too dey form ... i miss fidelity bank wey b d only bank wey all student dey pay dia school fees, u fit com in d mornin nd go in d evenin no lectures 4u dat day, wat of d ATM mechin, com see line.. seriously i miss zink hall wre d whole depertment dey take one lecture at dsame time... chai i miss seein al those kegite guyz gyratin nd playin dia drum in school gate every wednesday... lol na only God know wat chimaco nd his collegues ar doin now, who dem dey snap now.... hmmmmm abeg pass dis on 2 all ansu student igbariam campus,, o God
Posted on: Sat, 19 Oct 2013 10:33:42 +0000

Trending Topics



" style="margin-left:0px; min-height:30px;"> Fun fact of the day!! Possibly maybe even a myth buster were all
FORMER MEXICAN GOVERNOR VILLANUEVA SENTENCED IN THE US A US court

Recently Viewed Topics




© 2015