Lol! Abeg #Make_i_find_trouble_small_jare ! E don tey! All dese - TopicsExpress



          

Lol! Abeg #Make_i_find_trouble_small_jare ! E don tey! All dese babes wey na to FLASH dem sabi,na dere una own Love expression dey abi?, ! Una case dey court of love oo.. Dat 1naira /0.50kobo wey una dey use flash so, wetin do d airtime wey dey am before e reach dis figure?, Who una use am Call?. Oh! So, una get beta person wey una use am call finish, come carry change dey Flash that Correct guy wey dey always call una bcuz say him love una abi? Hmmm! E no good oo!. If una know say una no fit invest any of una thing (both Money &Time o) for Guy wey truly love una, abeg make una kukuma tell am na, no dey make am look like ADAMU.. D truth be say, Girl wey love u can neva eva Flash u; so tey worse come to worse, she fit borrow airtime, or use her mama- sista- broda phone call!.. E no dey commot anything from dem body, rada, na sweet joy e dey give dem.. So, ma fellow Broda s dem, una see those Flashers ehn? Bone dem! If dem no fit call,Lock up! But if na ur Confirrrm babe wey u know say dey call wella, come flash, abeg Sharperly call am back.. Abi i talk una belle so?
Posted on: Mon, 22 Sep 2014 14:38:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015