MONDAY 6TH OCTOBER, 2014 DSPG FORUM NEWSLIVE UNA GOOD - TopicsExpress



          

MONDAY 6TH OCTOBER, 2014 DSPG FORUM NEWSLIVE UNA GOOD AFTERNOON OOOOOOOOOOOOH!……............ I dor show today again this week oh! I still remain COMDR. UMUKORO OKIEMUTE JACKSON aka D’PRINCE OF INFORMATION aka D’NEWS NUZZLE OF DSPG aka D’UTE OF DSPG. Happy New Week and how una flex una last weekend? Hope una take am easy jollificate oh! Before I wor give una today and yesterday happenings but make I just read out all the Goodwill Messages from una first as usual.……............ Firstly, make I read the one from my good fan and friend MR. ORIABIOJE ONYEBIKE DESTINY………...D’Minister for Women Affairs, DSPG Chapter. He say he dey wish all our Muslim Brothers a HAPPY AND BLESSED BARKAH DA SALLAH. He still wish all DSPG STUDENTS from 2002 till 2014, a blissful week, and he still nor forget the Information Minister, COMDR. UMUKORO OKIEMUTE JACKSON a.k.a D’PRINCE OF INFORMATION a.k.a D’NEWS NUZZLE OF DSPG aka D’UTE OF DSPS. He say make God continue to bless him and the good work wey he dey do.……............ Mean while, BUSENI PEREAGBE dey wish all Great! DSPG Students, safe journey as dem dey go back to their crib (home) but remember keep GOD first……............ ALAKPA EDAFE still say he dey wish every DSPG Student success for the recent concluded examination and say make dem dey expect positive results.……............ All the way from Delta State Poly., Otefe-Oghara (DESPO) GOODLUCK UWEIRORO say make GOD MAKE una an access to una own generation and an umbrella wey go cover others. if you believe it Type AMEN! In faith oh!……............ COMDR. UMUKORO OKIEMUTE JACKSON aka D’PRINCE OF INFORMATION aka D’NEWS NUZZLE OF DSPG aka D’UTE OF DSPG dey join the goodwill messengers dey wish our Muslim brothers and sisters Baraka D’ Salah and urge dem to continue to dey maintain the love and peace wey we Christian know dem for and we pray Allah (God) to bless dem wella……............ NOW ON THE DSPG FORUM NEWSLIVE:……............ News reach me say BIGBROTHER AFRICA dor start yesterday 5th October, 2014 and dem call this one “HOTSHOT” with one male (TAYO)and female (LILIAN) representing Nigeria at this year edition.……............ Report reach me say rain dor dey fall for Ogwashi-Uku since 6am and stop 8.35am, while the rain start the same 8.35am for Warri and never dream to stop………………….. Comdr. Chukwuemeka Benjamin (AMCOS President, 2013/2014) on behalf of the Association of Mass Communication Students (AMCOS) yesterday dor joyfully wish to congratulate all the graduating students of Mass Communication Department and say the sky na their stepping stone. he add say, as dem nor mourn any of their colleague during thier National Diploma (ND) programme, so also dem go remain alive to complete their academic programmes for various levels. “Nor remove the garment of our prestigious Mass Communication; be a good ambassador Of the GREATEST AMCOS”, he still advise. ………………….. Mr. Efe Rex advise all the lovely heart say make dem try to dey understand say when somebody love dem. The person nor go hurt dem, cheat on dem, abuse dem, or take dem for granted. According to him, he say “If you dey relationship with somebody wey dey do any of those things, you keep on forgiving dem but if they still to do the same things, then make u just know say you dey deal with a passenger (wrong person)”.………………….. The Ex-President of Deuce Press Club of Nigeria, DSPG, Mr. Edobor Patrick Airvance dor advise say make we dey celebrate Jesus all the time, everywhere and for anywhere because He dey worthy of our celebration. According to him, “Jesus nor dey use twitter or facebook, yet, many dey call am, follow am and dey seek his face daily in for him book. Jesus wey fit recharge you without any charge, fit still give you more power pass American Actor, Jack Bawer wey act 24hrs America Seasonal Film to rise pass any tower”.………………….. “THIS MESSAGE NA FROM THE NEKEDE POLY TO UNA” “E dor reach the notice of the management of Federal Polytechnic Nekede say some fraudsters dey broadcasting text messages notifying prospective students of errors for their O.M.R forms and dey request them to pay some amount of money for corrections. The public is hereby advised to ignore such messages”.………………….. --------------------------------------------------- BELOW NA EXAMPLE OF THE TEXT MESSAGE Due to error on filling your O.M.R Form (Answer Sheet), Your result might not be marked. For ratification, urgently contact Mrs. Okafor Tochi 080-3477-2006. » JAMB Admission Letter for NEKEDEPOLY is dor ready.………………….. Enugu State Olokpa (police) command dor arrested one middle-aged man wey dem identify as Uchechukwu Ugwuozor because say he stab him Mama, Eunice Ugwuozor to death. The incident happen while the woman dey sleep in the early hours of last Thursday for Ubiekpo Abor in Udi local government area of Enugu State. “Sources close to the family say the alleged murderer get unresolved psychological problem”..………………….. While the Police for Ugbowo, Edo State, dor arrest one staff wey dey work for Chemistry Department of University of Benin, UNIBEN, wey allegedly forge the letter headed paper of the Academic Staff Union of Universities, ASUU, and signature of the Chairman of ASUU, UNIBEN Chapter, Dr. Anthony Monye-Emina. DSPG Forum received information say the police dor dey on his trail for over a month, though dem catch (arrested) am Saturday. The suspect dor dey use the letter headed paper dey write petition to the Minister of Education, where he allege say Prof. Osayuki Oshodin no fit to man the affairs of the university due to ill health, therefore the university need acting VC……………………. Still on UniBen matter. Last Friday for the office of the Vice Chancellor of UNIBEN, one woman wey the university authority sack for misconduct evade security and seized the VC, Prof.Osayuki Oshodin for trouser and cum dey shout say make dem reinstate her back……………….. ADVERT:……............ Oga Morrison say make I let una know say he dor dey all internet service @ MORRISON ACCESS WORLD BROWSER AND EDUCATIONAL CENTER for after Coconut Bar or opposite Diamond Bank, Udu Road, Warri, Delta State. Or call Morrison on 08063824341 or even or Comdr. Jackson on 08161829919.……............ NOTE: if u get anybody wey u wor wish better as DSPG 2nd semester dey come to an end, make u inbox the message. I go publish for my Newslive. Thank you.……............ THE VOTE dey still ON: Inbox me who u fit say be the BEST DEAN, HOD, SUG PRESIDENT, DEPARTMENT, SCHOOL, ASSOCIATION, BEST COURSE REP., BEST FEMALE AND MALE STUDENT and also not forgetting THE BEST LECTURER and the department wey dem belong to.……............ Na here I go take end my NewsLive for today but if you get any News, Announcement, Advert, Goodwill messages, Complains, Suggestion, u wor sponsor me, u need my assistant regarding anything or u wor partner with me, make u let me know via my inbox oh!……............ Motto: DSPG STUDENT MUST BE INFORMED……............ Na me D’PRINCE OF INFORMATION……............ D’NEWS NUZZLE OF DSPG……............ D’UTE OF DSPG……............ Nai dey give una this report so….……............ Student of DSPG did u know that your best cannot make u d best except God…….. By OVRAWAH PATRICK EMMANUEL.……............
Posted on: Mon, 06 Oct 2014 10:56:50 +0000

© 2015