MY COUNTRY Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading - TopicsExpress



          

MY COUNTRY Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading #200 MTN Recharge Card.=D Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship. =D Then Airtel go com follow sey, recharge #100 an win benin republic. =D Glo, go jus kuku say... Recharge 500 and win Nigeria because there colour na Green =D Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE" =D Na only for nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines.=D Na only for Nigeria PHCN dey sey: Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a piti)=D Na only fo Naija people dey horn for traffic light make e quick change frum Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer.=D Wetin you u no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me. Abeg na joke o, no take am personal O =)) I love Naija!
Posted on: Mon, 26 Aug 2013 13:34:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015