Make unna free Ronaldo 15 Jun 2013 07:32:59 Clyde Tlou - TopicsExpress



          

Make unna free Ronaldo 15 Jun 2013 07:32:59 Clyde Tlou Translated by I Shittu The tok tok wey dey ground now on weda Cristiano Ronaldo go kommot for Real Madrid don dey enta anoda gear and de time don reach make de club presido, Florentino Perez free am make him dey go. Na Real Madrid fan I be, and walahi na bicos of de beta ball wey dem dey tap na im dey make me dey support dem and make we tok de truth, Real Madrid ball change well well since de time wey Ronaldo join dem from Man U. The beta ball wey dem dey play sef kon dey sweet me bicos wen dem nack dia opponents attack, you fit guess who ness go collect de pass and even Mourinho sef tok am say “we dey create plenty chance for Ronaldo and I like am as him no dey waste time waya de gols,”. The paro work well well for Mourinho for him second season wen him be de oga manija for Real Madrid as dem win de League, but him lass season na helele as Real no gree win any cup at all. Now wahala don dey happen as Ronaldo don dey think say him big pass de club and I don dey tok am say make dem allow am kommot as Bale fit enta him shoe and na even bicos of Real Madrid dem born am de guy sef. Oga Perez, make Ronaldo waka De time wey Ronaldo kommot for Man U in 2009, plenty people miss am die for Old Trafford as him helep de club win 3 premier League title and one champions League in 2008, but na afta him carry him bag enta Madrid na hin oga Mourinho kon dey tok say Ronaldo dey give am wahala as him dey do like say him sabi everything. “De only wahala wey I dey get with Ronaldo be say him too dey form like say him sabi everything pass de coach sef as him no dey gree hia anything wey we tell am,”. Naso Mourinho tok. That mean say Ronaldo don reach make Real Madrid sell am kommot and de way wey him dey toy around sef as par new deal suppose don tell Madrid dat de guy no wan play for dem again as I wan make dem helep am pack him load sharp sharp. Real Madrid na ogbonge futbol club wey get reputation pass Man U and my belle sef juss dey pain me as dem wam helep a playa wey no wan helep himsef like say na him sabi tap ball pass for dis world. I don dey hia say Monaco and PSG don dey eye am as dem wan make Ronaldo sign for dem as de two clubs don dey build diasef for ness season, but na Man U go make sense for de guy and na dia I wan make him go. If C Ronaldo no kommot for Real Madrid, den e mean say de guy wan become legend for de club be dat like Raul, Zinedine Zidane, Alfredo di Stefano, but Ronaldo wey be 28 years neva reach dat kind leve
Posted on: Sat, 15 Jun 2013 22:39:34 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015