Mede mede xtra We hail una dis ogbonge Monday ontop Sports - TopicsExpress



          

Mede mede xtra We hail una dis ogbonge Monday ontop Sports Radio.Happy New Week o. My people we wan shook mouth put as e take concern the FA cup fourth round wey shele for Weekend as two giants fall yakata comot.Bradford city wey play Chelsea dey play for League One for the third tier for English football league system while Middlesbrough wey kpokpo Man city dey play for the Championship. With the kine football and lose wey Manchester city and Chelsea lose for weekend for the FA cup, my people shey na the EPL abi Champions league title wey dem dey pursue make dem lose like dis abi the championship and League one sides dey too strong for them?. Oya make we yarn
Posted on: Mon, 26 Jan 2015 13:50:29 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015