My funny experience[Written in Pidgin English]. ENJOY!!!! E get - TopicsExpress



          

My funny experience[Written in Pidgin English]. ENJOY!!!! E get one particular restaurant wey i tke dey chop 4 G.R.A.E get one oyibo wey dey always come chop there too...Any time dis oyibochop finish he go shout Hey! so I wonder wetin dey make am shout, i decide to chop wetin d oyibo dey always chop so maybe me self go shout too.. when i reach d restaurant last week friday, i order wetin d man dey chop..Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am,but i no shout, i colet xtra plate, but i stil no shout..na then i just vex ask 4 my bill. D waiter tell me say one plate of chicken & redwine na N75,000 then d xtra plate na another N75,000....na then i shout hey hey hey hey,I still dey shout till now..
Posted on: Thu, 28 Nov 2013 10:43:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015