My people I salute una o.our people use to talk am say na only - TopicsExpress



          

My people I salute una o.our people use to talk am say na only person wey no ready for life go ask blind man for direction. plenty tins dey happen4our ijaw community dem.but as our elders dem talk am. waka man dey see sumtin. dis evening we wn talk abt dis our governor for bayelsa.Dickson sitdown he no know wetin he go do or how to provide job for those jobless youth.imagin govt of bayelsa state go grant amnesty to cultist for bayelsa nawa o.I still dey hear another rumour say federal govt wn give amnesty to bokoharam wey just wakeup one mornin start to dey kill,bomb mostly d christain for north.for no just reason.well I pray mke he just b rumour as I talk am b4..I wn just send dis messge to my oga@d top abeg mr president grantin bokoharam amnesty no b word wey anybodi suppose to dey suggest.infact I expect our president to jail anybodi wey suggest say mke dem give those pple wey dey waste life nd property everyday for nigeria amnesty..as for Dickson if na mistake u take give those cultist for bayelsa amnesty I suggest u go correct dat error bcuz na stupid tin for u to give cult boys amnesty all d names of repentant cultist no mata d crisis those boyz dor cuz.as long as dem b cultist and not a freedom fighter.d no diserve amnesty.I know y people wey dey do bad tin kill innocent people na our govt dem recognise nd dey reward dem hansomly..Dickson advise no b cuz.givin those boyz amnesty will only increase d number of cultist in bayelsa.bcuz even those wey no b cultist b4 go like join just bcuz there go reason am say na through cultism their friends take get amnesty. people say na shame for elderly man to behave like omomo..I know say very soon na harm robbers there go begin to dey giv amnesty
Posted on: Sun, 28 Jul 2013 19:17:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015