NAIJA PIDGIN PROVERBS/TALKS • Pikin wey talk say him - TopicsExpress



          

NAIJA PIDGIN PROVERBS/TALKS • Pikin wey talk say him papa no go sleep, him sef no go sleep. • Pastor wey no get money to buy gold necklace for wife go say all na vanity. • Man wey carry Ogbono soup pot for hand and the man wey carry fufu for head, na who go find who go? • Chop alone die alone. • Na when soldier slap you, you go sabi say police na your friend! • Person wey no get money go say small stout dey bitter. • Peson wey say ur water no go boil de no go sell stove 4 him town? • If mohamed no go meet mountain, then mountain must go meet mohamed • Cow wey no get tail na Baba God go help am pursue fly. • Na small pikin wey no know em mama boyfrnd dey call am uncle • Na monkey were wan see hunter face dey chop bullet. • Bird wey choose to petch 4 rope, make e ready 2 dance alanta. • Pikin wey dey 4 back no know say road far. • Better soup, na money kill am. • Leaf wey sweet, na em dey kill goat. • Better soup no dey remain 4 pot • No mata how nyash clean reach, na back e go still dey • Gentility without ability na baba for stupidity • Bag no know wetin another bag dey carry. • Dem no dey tell blindman say rain dey fall • Monkey dey work, baboon dey chop • Pikin wey never reach another person papa farm go say him papa farm big pass. • Na the mouth way chop onions dey make eye cry. • The cane wey den take beat first wife, na ontop roof dem dey keep am wait second wife.
Posted on: Fri, 21 Jun 2013 09:38:55 +0000

© 2015