NEVA LOOK DOWN ON ANYBODY Before u dey use bb dey buga!... now - TopicsExpress



          

NEVA LOOK DOWN ON ANYBODY Before u dey use bb dey buga!... now everybody don get bb, Before u go dey use ur camry dey buga!..nw boys don dey use am do cab, B4 u dey use ur plasma screen dey swell.... now dem don dey use am watch ball for buka, B4 u dey use ur ipad dey swag... now ipad na heavy load to carry commot 4house, B4 u go dey use brazillian hair dey form big... now secondary skul student don dey wear am troway, B4 u dey go vacation 4 uk dey talk pass urself... now boys don dey buy 1st class ticket dey enta london jux to go lick ice cream, Bottom line...no dey over do like say dat tin no go reach anoda person hand,All na vanity,e dey fade like Aba Jean. nor 4get say tortoise car na big man motor b4 o... Notin wey come wey nor get expiring date, even the life you have na borrow you borrow am. Humility na the best choice
Posted on: Sat, 25 Oct 2014 19:44:45 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015