NOON NEWS/UPDATES. Bad Electricity Distribution Company (BEDC - TopicsExpress



          

NOON NEWS/UPDATES. Bad Electricity Distribution Company (BEDC a.k.a PHCN/VEGEO + NEPA)= Darkness Distributors, don start to dey share estimated bill of outreageous amount dey follow Sapele say nai be light bill wen pipo consume for d month of Janauary. Our studio reject dat kind billing becos Sapele nor dey get lite, how manage d bill con high? SAY NO TO ESTIMATED BILLING. Start the fight now! Some Ijaw Presure Group E.P.A pay condolence visit to Warri North L.G.A PDP Chairman base on their regards for d PDP Chairman wife wen died, d Leader of d group na Hon. Dio Tagan wen be d Vice Chairman of the L G A. Report land our studio say, d PDP Chairman wife slump and die some weeks back for Onitsha motor park wen she go travel. As we dey update so, d funeral of Late Hon. Charles Okiti, dey go on now. He corpse leave Okparavero Memorial Hospital dis morning wit black limousin. Our man around town inform us say, d family wear serious black and black. As dem dey lego Hon. C. Okiti for ground now, I use black handky take wipe my tears as I lite one candle for my studio take pray make God accept he soul. Hausa pipo wen dey Yoruba Rd by Hausa Rd don use scrab take block one fine new house wen dem build 4 there. Na so, so thief things dem dey sell there and na so small children dey thief go sell there. As we dey try to make d town clean, these hausa dem dey make am dirty and unbearable 4 pipo to stay. Abi make we pack leave our papa land for hausa? As we dey warn dem wen dem nor wan hear, d day wen wahala go start e go b like biafra war. Na so, so, noise of kpokpokpo. Morning till nite. D area pipo nor dey fit sleep. Govt nid to pack these scrab pipo go outskirt of town becos e nor get positive effect 4 d town instead e dey abuse our kids (stealing) our youth(igboo) and our parents (sleepless day and nite). D idiot wen park dat catapilar 4 Abeke Rd opposite Osioh Houx, try make u go comot am. I dey foresee say dat place go soon dey take blood if dem no remove dat catapilar from there. FROM EKU Pipo of Eku Town nor dey use eye dey see light most especially Agiri Estate wen near Eku Abraka Rd via Okuechi Rd. Dem don dey suffer light badly as their Transformer dey near Gboko Hotel. We hear say if light come na d strand of thread u dey see for ur bulb but now d transformer don finaly kaput since 2 Weeks now. We dey call on BEDC wen dey Eku axis say make dem go rescue Eku Town for light matter becos na total darkness nai d entire region of Eku dey experience. Mr Richard Ejakpemi of Zenith Education Centre, u get case to answer from my studio soon. I just dey look u with one eye first. D gbwa fit make ur shamughe body small pass so. So correct ur brain b4 I go nack u d gbwa wen go make u close up ur bizness. Na ur First and final warning nai be dis. The contractor wen dey handle Ethiope Primary School Okurighwe beautification project, don finally run leave d work. As we dey report so, d red sand wen d man park full d skool all in d name of inter locking, still dey d school premises on touched for d past 3 months. Oga contractor, if u don wack d project money, u bettdr vomit am b4 I go open ur chapter give EFCC. *WANTED Dem need the services of a Sales Girl for BAWO PINKS Boutique. Salary very attractive. Call 08068048808 God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 07 Feb 2014 12:45:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015