Nigeria don reach 53 now and na for Nigeria u fin win Aeroplane by - TopicsExpress



          

Nigeria don reach 53 now and na for Nigeria u fin win Aeroplane by loading#200 mtn recharge card. Very soon Airtel may say recharge #100 and win a big ship then etisalat fit follow say, recharge...#20 and win burj al Arab hotel in dubai. Glo go jus kukuma say: recharge 500 and win Nigeria cos thier colour na green. Na only for Nigeria you go see fish inside "MEAT PIE" na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM becos we no even trust ATM machine. Na only for NIGERIA PHCN can fit talk say: win a brand new GENERATOR if u pay ur light bill (wat a pity). Na only for naija people dey horn for trafic light make e quick change from red to green. Na only for NAIJA....Pharmacy dey sell coke, recharge card, chin chin, puff puff, ogogoro and bear. Wetin u dey see for naija, u no fit see am any where in d world..Naija we too much. Am proud of where i come from which is Naija.What of u??? Hapi BIRTHDAY my father LAND..
Posted on: Tue, 01 Oct 2013 12:37:07 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015