Nigeria na one country, yes The thing God done put together, let - TopicsExpress



          

Nigeria na one country, yes The thing God done put together, let no man put asunder But sha if we no go scatter am we must balance am well well Everybody must happy Some no go dey belle full make others dey hungry, Haba One day hungry man go angry o Leadership, government, president no be personal property Power no be birthright Equal rights and justice na him go bring unity and progress Solution to make Nigeria better, E dey here for Naija If we find better leader Nigeria go better o Correct brain with correct solution he boku for Naija Haba, sebi na chop chop na him close sense Oyinbo wey him organise, se him get two head Hisshh, Naija it done swet before before o, It must sweet again gan Country hard, country hard (horns) Na him I pack my load, I check out Baa ba nrelu oyinbo ka mohun a nwa lo (horns) En I dey o I dey go I dey go ilu oyinbo Se iyawo wey he never taste two husband house He no go know which one sweet pass (horns) Because of pounds and dollars I face yankee My visa expire still mo nfa gburu (horns) Otutu pa sege olopa o de gbodo gan mi Emi omo onile olona mo wa di gbaatu eyo (horns) If I greet oyinbo for road he go point him nose for sky Emi omo afojapon omo onile olona, big man for my area Wolukilumo, Eni ko o mo eni mo o ko Iya mi o gbodo gboya to nje mi aya nbe nile omo nsuffer Haa, kese, mo ranti ile mo forin aro bonu Oh my home oh my home, When shall I see my home When shall I see my native land, I will never forget my home After my eye clear I pack my luggage ile ya Ko baje funlu oyinbo enough is enough Before I get visa nko I know how I suffer Mo tun wa debi tan perambulation (horns) O yes I made some bread man, but home na home now (slam horns) If them tell you say yonder dey sweet gan, is a lie Many of my people yonder na suffer head (horns) Oyinbo self nko, illiterate boku, some cannot read, some cannot write Ignoramus asoyinbo naa le tabon (horns) Me wey I think every oyinbo get money haaa Ase many of them na poverty (horns) E ma si mi ye oo mi o so pe ilu oyinbo o dara (slam horns) Of course o dara lopo, organisation correct ni But as we get our problem them get them own (horns) So why can’t we too sit up and do something, wake up let’s make life easy Yeah yeah Naija o ni gba e Oke ga joke Olagbaja ga ju won lo Oke ga joke Naija ga ju won lo Oke ga joke Africa ga juwon lo …………………Naija must sweet gan Before before Naija sweet gan o But now Naija bitter gan We must find a solution kia kia Naija he done sweet before it must sweet again o It just be like yesterday when everything change o Little by little everything yamutu Titi titi everything come dabaru like tailor leg o As it be for Naija na so for Africa Oh I sorry for Africa How the future he go be for our children If you suffer and your children them no suffer At least you go know the thing wey you suffer for But as I dey look am so Them own suffer head na him go terrible This one na multigenerational disaster Except we wake up and we do something now The problem wey he dey for ground it done pass for example Se na foreign exchange we go talk ni abi na corruption make I talk ni Oh I sorry for Africa Ehhh everything just dey bitter now Ehh everything just bitter o Naija must sweet gan and me I no go thief For my very very before it must sweet dan dan Naija…… Naija……..Naija na my country it must sweet ni I no go run anywhere home na home now Naija must sweet gan, it must sweet ni Naija………Naija
Posted on: Wed, 09 Oct 2013 06:52:45 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015