Noon News/Update Report cum say nor be DLA dey repair Ugbeyiyi - TopicsExpress



          

Noon News/Update Report cum say nor be DLA dey repair Ugbeyiyi Road, say na one of my classmate Adams Timeyin wey be former Koko (Warri North) Chairman before dem Ejele smell power, nai dey do the Road single handedly. Na so e still use him influence den take do all d Roads wen lead to e House go jam Esiri Rd. If na true nai be say all ur problems, even d one wen u nor know self, God done commot am from ur back In Jesus name. (If u like wetin dis Man dey do hala Amen). From Asaba yesterday nai our Governor for address all Deltans to dey respect peace and shun carry talk against the Government. Also e urge us to support the Government with supportive ideas wey go fit uplift the growth of the State to the next level. Mona Motessoris School, after parents don pay their children school fees finish, unu con re-slam dem with another payment of 15k each, say unu wan build school hall. Unu really dawa (try). What of who get 4 children? Na osusu unu wan do now? Make unu control unuself b4 d school go fall press unu. Make unu use from d school fees, to build unu hall. Report fly enter my studio say, one Esther Oyibo, forget he documents for Onosigho Park dis morning. Who know her, make e tell her say her documents dey intact for Onosigho Park. Via Sms! Hon. Austine Ayemidejor say make we all stand from our studio, helep am throway special greetings give His Excellency Governor Emmanuel Iweta Uduanghan as e clock 59yrs old yesterday. We blow 2 Awilo for u. Via Sms! Hon. Julius Egbedi wey be the current caretaker committee chairman for Sapele Local Government say him nor fit shout am alone,as e join e voice wit our own to salute our Governor Happy Birthday and e also wish am many other fruitful years to come. Via SMS. Hon Henry Ofa say nor be only DRTV Radio nai dem go for hear e name, say make we helep am tell Governor say e enemy nor go fit clap for e head. Say as God dash am dis year na so God go dey do am for am dey go all d days of e life. Hon. Godwin Atose say e know say e nor too get money again, say but e still get mind to develop Sapele and e say make we helep am salute our Governor Emmanuel Uduaghan as God stone am with dis year. E say na so so better tin go dey reach our Governor hand, as e clock one yesterday. Via SMS. Hon. Godwin Ebosa throway money for our studio roof say make we helep am greet His Excellency Emmanuel the Governor of Delta State Happy Birthday and e also ask God to bless the Governor with long life. One Sapele boy dey compete for dis Gospel Rising Starz (GRS) competition wey dey go on now 4 Enugu...abeg make unu vote for d boy. Na him dey represent Sapele 4 d competition. E code na text GRS 15 and send am to 33810. Gideon Agbona nai be e name. na e papa dey use one NDDC Mass Transit bus, No. 099 for d town, take dey run Onitsha. **SAD NEWS** Report just fly enter our studio say, Tukeke wen dey sell spiecis eregheje near Oga John meat for Market, don finally die. As we report to unu dat on b4 say, her husband, wen God go purnish, use her take do rituals. The thing pain us well, well for studio here, as we pray for her soul to R.I.P. But, make u drag ur ritualist husband follow body. Abeg make we wish Tukeke fare well by typing R. I. P. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Wed, 23 Oct 2013 12:15:27 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015