Noon News/Updates 02/08/2014 All indications don dey show - TopicsExpress



          

Noon News/Updates 02/08/2014 All indications don dey show red medically for our studio as report don samasult enta studio say Nigeria Medical Association (NMA) wey be d umbrella body of all doctors for Nigeria norva ready to come out from their strike action wey don cripple d activities of Government Hospitals for the past 2 months. Wey our man around town visit some medical personals on code, we con hear say, Federal Govt dey suggest say make non medical doctors dey held Ministry of Health as against the policy of the profession. As we dey update so, the NMA norva sight their MOON wey go make dem end d industrial action soon. BEDC, don appeal to residents of Shell Rd, Ugbeyiyi and all areas wey the Amukpe Sub-Station, say make unu nor vex as d 7.5MVA Transformer wey dey supply unu lite b4 don kaput. Wen we trow call enta d BM office, Mr. Orukpe, he con clear us say their focus now, na to install new 15MVA or 30MVA Transformer wey go give d affect areas constant lite as dem be dey get, soon. BEDC dey beg unu truh dis medium to bear with dem. We still dey use dis update dey call on BEDC to go rectify all d faulty transformers wey dey d town. As d cry of black out don full my studio. If unu know say unu area transformer dey faulty, oya make unu comment am under dis post. Our studio troway salute to New Salvation Clinic and Gracevile Clinic as d way and manney wey their auxilary and real nurses dey dress dey trip my studio. Na d way Oyibo pipo dey dress nai dis two Hospitals don adopt. Make unu clap for dem. Dat na to tell unu say Sapele dey upgrade. We salute 10 ova 10 as report reach us say wey we go break, nai dis handsome boy wife born succesfully. We thank God for safe delivery. Also 10 ova 10 don dey build he new saloon afta dem use he Caravan take do tooth pick during demolition. My smally Amakeke, oya visit my inbox for pressing issue. Report reach us say Omene Road for back of Ebenezer go reach Oley Road for Idon Hotel area nor dey c light at all yet BEDC dem dey increase Tariff last month. This area nor join d four hour plan infact dem nor dey any plan at all. We nor know the problem abeg. For three days dem fit bring am 10min most tym dem dey LOCK UP. Make unu wey dey work for field go rectify dis area fault becos dem nor dey craze to dey pay bills. Report enter studio say make we throway congratulations give Chief Dr Speedee, as he chop chieftaincy title as d Jesukenu of Agbon Kingdom on Saturday 26th July 2014. We rub powder of breakthrough for ur body and we pray make God give you wisdom make take dey settle issues. CONGRATULATIONS!!! Report reach us say one of our fan Adekunnle Mukiala kunaw, wey e father get Taloring shop for Reclamation close to praise jah Bakery and na Muslem. D Man just collapse nai e die for deir meeting on sunday. Make unu pray for e soul oh. * Training! Training!! Training. Suzys Creativity dey bring to unu door step how to make d following for just 5days training programmes . SHOES. Slippers *ballets or flat shoes *heels(wedges or stilettos) BAGS Clutch purse *chain bag * tote bag. ACCESSORIES Bangles *Earnings *Neck pieces * Hair piece and bow. Registration/Training fees for each packages. Shoes, bags and accessories + materials na just #30,000. Shoes only #15,000. No materials Bags only #15,000. No materials Accessories #5,000. No materials Dem reserve dis programme for just 10 people only. Na First come, first serve ooo. So make urself available 4 this discount prizes. Registration go end 28th August, while d training go start 1st- 5th September 2014. For more information, make unu telephone dis fine space teeth Suzy for 08077771196. Or make unu ping her BB pin: 25D33D1B. Our studio troway welcome to ELOHOR OKOROZE as she dough enta Sapele con charge her phone. U are welcome oh Elohor. My MBQ Camera see u for Ogorode. GOD BLESS SAPELE SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 02 Aug 2014 13:30:41 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015