Noon News/Updates 30/05/2014 Report use HIS MAJESTY - TopicsExpress



          

Noon News/Updates 30/05/2014 Report use HIS MAJESTY SCHOOL take enta studio say President Goodluck Jonathan during the interdenominational service to mark our Democracy Celebration, he con thank God for the 15th straight years of Democracy for the country as he talk say dis na the best form of Government. He don assure Nigerians say by next Democracy Day the country go witness new Government. Report use MONA SCHOOL take enta studio say keke riders for Delta State don join their voice as dem dey call for the immediate release of the abducted Chibok School girls. The keke riders under the aegis of the Delta State Motorcycle and Tricycle Union of Nigeria carry placards as dem march through major streets for Warri and Effurun as dem dey distribute flyers wey dem write Bring Back Our Girls put. Report use ERIS SCHOOL take enta our studio say the second Edition of the Urhobo art and culture advancement award go take place today friday 30th of may. And na the Urhobo Cultural Centre, Uvwiamuge Agbarho nai dem for go do am. As we dey update so, d event dey go on now. The leader of the group, Joseph Orekereke don yarn us say Urhobowood nai be the Urhobo version of Nollywood for Nigeria. Report land our studio thru ST LOUIS SCHOOL say some parents dey fear to talk come out but dem dey grumble with d way and manner wey OUR SAVIOUR SCHOOL dey treat deir children as the School authorities know the level of Traffic jam wey dey disturb all Shell Road users every morning due to d constant rush but the School authorities go still dey drive Students go back home due to say dem cum late small. I dey call on the School authorities to flexible deir strictness so dat d Children nor go find am difficult to cope after the big fees wey dem dey pay. Also the School Teachers salary scheme don due for increment. Report enter studio thru OUR LADYS SCHOOL say big name Kingsley Jeremi a.k.a KJ don throway special apologies give Varere Mujakpero the apple of his eyes say he dey very sorry for anytin wey e do against am and when we look d mata well we cum see say really KJ wey be proud man finally submit e pride down do dis apology and we throway our two ampit for table take beg Varere to comply becos e nor go good if Varere Mujakpero begin start her early life wit 2 gates and e go also bad if d pikin get two papa becos we dey try correct our parents mistakes of two gates and polygamous life. The tin still fit cos Trauma for the pikin body too. Report use INTERNATIONAL SCHOOL take enta studio say Joshua Ubaga wey dey manage one cleaning outfit for dis town and he dey drive one white pick up don dey use he female workers as bed shit with he blokos. Joshua Ubaga if u nor want dat ur gorimakpa to chop pass so, stop to dey doke ur female wokers. My eyes naked for YOUR body as from today go. Report use OBULE SCHOOL take enta studio say as we dey celebrate Democracy Day yesterday, one Female Craze wen naked completely begin terrorize pipo wey dey Gana area just afta ABC Chemist. Na so d kolo just dey fling pipo tins dey run until one man begin chase her wit big wood. We dey call on d Uselu pipo of Sapele to go get rid of all dis numerous kolo wey full d town so. Report use ANDOMA SCHOOL take enta studio say one Okada man get accident break he leg for Cemetary by Ogaga Rd Junction dis morning. Na so d guy dey shout in pain for ground O GOD, MY LEG DON PULL OH, MY LEG DON PULL OH. I pity for d guy. Make God take control as we caution all Okadas to ride with care. Report use FAITH NURSERY SCHOOL enter studio say one Electrician wey yellow and e young wen dem admit for Oghara Teaching Hospital for Oghara die yesterday for Oghara after e don dey struggle wit life thru oxygen. Dis padi wen die so norva born and e just dey ready to settle down for life. Na Urhobo Rd by Blessing drinking spot nai e workshop dey and e name na Steven according to e sister wey we interview for Oghara wen she dey cry. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 30 May 2014 12:10:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015