Noon News/Updates. One new and efficient body wen dem dey call - TopicsExpress



          

Noon News/Updates. One new and efficient body wen dem dey call ECC, don start to dey control Traffik for different junction for Sapele. Dis group made up of young men and na so dem tanda for different locations for Sapele as dem dey ensure d free flow of vehicles to avoid traffic congestion within Sapele Metropolis. Sapele Meat Dealers and Slughters nor kill meat today as dem dey observe One Day mouring for BABA T wen slump and die yesterday for hospital. , BABA T na very good and generous man with good heart. He death na big blow to many pipo. As we dey update so, d entire Meat Dealers dey cry over d sudden death. Pipo still dey troop he houx for Uruakpa to go pay he family condolence visit. BABA T na man wen die leave he wife and 3 Children. General Hospital Sapele, unu emergency ward services dey very poor and unu nor dey give attention to pipo wen dem rush come there. Na two death nai we record yesterday for unu emergency ward due to unu lackadiskited slow attitude to attend to d pipo. Unu even dey refer dem to oda hospital for town just becos say unu nor want disturb. Unu cup go soon full. Na No Work, No Pay policy nai Oga Uduaghan go soon apply. All the warders wen dey serve for Sapele Main Prison, all of unu na corrupt pipo. Unu dey take bribe from inmates. I don get fact and figures wen I wan take nail unu as unu don dey enrich unu sef with bribe money. ECOBANK for Malachy Junction experience light problem today as dem nor fit buy diesel for their plant. Na from gate dem dey direct pipo say NO LITE go d oda branch. Wen u reach d oda branch, dem go tell u say NO NETWORK as na only deposit u go fit do and u nor go fit withdraw. Unu beta network unu network well becos customers don dey over vex for dis unu re-occuring decimal of Network failure. Onos Itachemi wen dey stay Adidi Rd and na Level 12 officer for Delta State Civil Service. Ur gbwa of how u take dey dupe pipo through newspaper go soon land. We dey tidy ur details and if we release am, we go make sure say we copy The State Governor. I pity for ur work becos u don use ur hand take pack shit for ur face. Watch Out! Massive work dey go on now for Igbuya Fuel Station wen dem dey build for New Rd by Akintola Rd Junction. Na so many loyalist of Igbuya full d premises as dem dey do afamako talk of where d crane go dump d big tank put. Unu nor knw say too much cook, dey spoil food? We dey draw d attention of Oga Jullius Egbedi to go use he two naked eyes take see wetin dirty don curse for Mission Rd. As we dey update so, d heap of dirty don take part of Mission Rd by Berdi Ground. D tin nor too good for eye. Na 3 days ultimatum nai we give u to go take care of all d dirty wen dey Sapele. Nor let me tag u as d most Dirtyful Chairman wen Sapele don produce. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 10 Feb 2014 12:53:27 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015