Noon News/Updates. The Marriage wen dem do for Ufuoma Rd - TopicsExpress



          

Noon News/Updates. The Marriage wen dem do for Ufuoma Rd yesterday wen cos serious Traffic for Oleh rd nd Okpe Road cos for d Town experience gadamentation of different old pipo wit New Cars. D road rubbish as people just dey match portuportu. The Rice sweet,but e dey smell 2much curry and d meat dey cent bitterleaf. Na one short Girl wen dey teach for Our Ladies School wen Ota born nai marry for Laboard Rd yesterday. Na so d Couples just dey do like say na dem fine pass. Ufuoma Atose just dey spread like who win Pool. Urban Area children paint body white dey hussle for cash. Short Perkins Otughwor sister just dey sasoma like who sponsor d full marriage. The Groom family just dey rush wak like say na d first time dem dey eat deir pikin money. Drinks nor go round sef. If nor be dem Erima,Buko younger broda and Ufuoma Atose,i for nor taste drink. Christ Embassey Pastor absent for Church today. Na Pastor Chris Video nai dem play for pipo wen attend Service today. Tosan wen nor go Church cum dey happy say she nor go self,why Miss Diden enjoy d sevice well well. Dem use offering take drive me. Madam Tinko wey dey claim say she na Odebala wife go bring Police yester nite go manager compound for urban area say dem be cultist dem cum arrest abt 5 boys wen sit outside . Nor be small beat police beat dem break all ,d white Chairs dem sit down. For watin dem nor be. Dem even still dey Main Station til now. The People wen police catch so na, Monday, Tobore dis 2 na manager pikin Abonbe, Uche all dis na friends wey dey stay around n d last 1 na, Akpomughe he dey stay d compound . DPO release dis guys make we nor quarrel. Report just land our studio now say RECEMBO FILLING STATION wen dey Adeola Rd for former Agip witness pandamonium dis afternoon,as one woman dey vaga for the Filling Station. Oga wen get d filling Station,abeg look into d matter,make dem nor go burn person wit fuel for Sapele wit anger. We dey use dis update dey suspend the Gbwa wen we package for Mrs Azigbo wen dey sell Paint for opposite Oxford Hotel. Also we from our inbox don resolve d issue wen concern our studio and Egba Omokiri. We go soon drop JENNIFER SMART Gbwa from Stove. Today we dey celebrate Mrs Austine Ayemidejor as she dey very calm,accomodating, she nor dey nag but her swag tight. Though her Husband nor dey too spend for her but she dey very classical. Make i go Mrs Ede Azigbo place go chop Rice,as she dey do her 50yrs Birthday celebration for Mission Rd and na Pan Cake dem warn share as Sorvenier oh. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 19 Jan 2014 12:38:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015