Noon News/Updates World, African, UN, AU, Ecowas, Ecomog, - TopicsExpress



          

Noon News/Updates World, African, UN, AU, Ecowas, Ecomog, National, State and Local Goverment Renowed Debtor wen dem dey call Semekolo (Deacon Emekeme), open he two naked eyes and frog face go arrest one teacher for Mona Montessoris School dis morning. Our man around town nai inform our studio say, just becos say, d teacher discipline Semekolo pikin with cane for school yesterday, nai Semekolo carry police go arrest d teacher dis morning. Which kind father u be Deacon Emekeme? Abi d debt wen u hold follow dis life dey affect ur brain? D kind hala wen Semekolo hala for d school today, affect d children learning. We dey call on Mrs Ferdman wen dey head d school to cordinate her school well and Deacon Emekeme Semi-Orhewe must tender unreserve apology to d school. D yeye policeman wen go do d arrest, ur name and batch number dey our studio. Report fly enter our studio say one tanker wen carry Gas burst 4 Okada junction along Lagos Rd. We thank God say nobody injure as d tin cos beta hold up for d Road. Na our studio shoe-maker wen dey travel dey go Lagos dis morning nai inform us. Update about d Kidnap of Mama Excel Na One Million Naira nai d kidnappers dey request for as report land our studio say d kidnappers don contact d family yesterday evening. Sapele pipo, Na for Benin dem for kidnap her with five other people (1 male, 5 females). Na dat on wednesday wen Mama Excel dey go Lagos with Ejiro Onovughe Bus nai dis thing take happen. Na around Okada Area along Benin/Lagos Road nai dem for do d kidnapping as the kidnappers select the six people and leave the remaining people for the bus after dem collect their belongings. We pray make God helep d family during this period as we naked pray fire for dos Edo State kidnappers head. We dey draw d attention of Federal Road Maintainace Agency (FERMA) to go attend to dat Death Trap pot hole wen dey along New Road b4 dat place wen Jomaph dey dredge. D pot hole don cos many accidents. Na dat pot hole nai claim d life of Late Okpeyor. Make unu do sometin fast. Okpe Road don dey experience high level of traffik jam. Big, big lorries don dey over dey carry drive along dat Road due to d blocking of New Rd by DLA slow posion workers. If any Lorry run enter any compound or damage anybody houx, make unu hold Chief Lucky Ayomanor responsible. We dey use dis update to inform all bike riders for dis town say Bad Boys don dey obtain pipo for dat New Rd by Adeola Rd. I mean d small route wen bike men dey manage dey pass for dat place, bad boys don dey use d avenue of d bike men slowing down to dey obtain both d Okada and passengers. D bad boys dey carry out their thiefmatic act around 9.30pm and beyond. Police, Army and Navy take note. Okada men and passengers be warned. Na wetin Chief Ayomanor Lucky dey find be dat. *RITE OF PASSAGE Sapele Talented and Rock Defender Late Goddy Ovieghara goes home 2mrw. Dem go do Last Respect for am for Sapele Stadium 2mrw by 9am. After d last respect, dem go come carry he corpes parade round Sapele Metropolis. After dat one, d mortal body of our football heroe go con finally go rest for he home town, Eku. We dey use dis update to invite all Ex-footballers, current footballers, future footballers and Sapele Coaches to come out en- masse to pay their last respect to dis Sapele fallen football heroe. May his soul R. I. P. Amen. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 31 Jan 2014 13:03:19 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015