ORIDOTA questions and answers..... 1.He who fights n run away? Na - TopicsExpress



          

ORIDOTA questions and answers..... 1.He who fights n run away? Na fear catch am, E don Surrender. 2.A rolling stone? No fit just dey roll, na person push am. 3.He who lives in a glass house? Na rich politician e go be. 4.A stitch in time? dey prevent further tear tear. 5.Birds of d same feather? Na d same mama born them. 6.One good turn? Na correct power steering fit do am. 7.A bird in hand? Wetin e wan be again if nobe barbeque. Dem plenty for chicken republic. 8.Half bread is better than? better pass kolobe & garri without sugar. 9.A journey of a thousand miles? Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or aeroplane jeje? 10.He who laughs last? Get brain problem. Make dem examine am becos na begining of madness be dat. 11.A patient dog? Na hunger go kill am. Ebi lo maa paa ku. 12.All work and no play? Na bank job be dat, Ise laago se ku. 13.Once beaten? Na revenge go follow b dat, Ipadabo Abija....... 14.A fool at forty? U never see Naija own, ours starts @ 30 Oponu 15.A friend in need? Na Yeye Akuse parasite b dat. Oga na Olorioko, na me be number 1 ke, 15/15 100% sebi?
Posted on: Thu, 18 Jul 2013 09:47:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015