OUR TOPIC TODAY FOR OUR OBODO NAIJA 12:30PM- 1:30PM: I be 42 - TopicsExpress



          

OUR TOPIC TODAY FOR OUR OBODO NAIJA 12:30PM- 1:30PM: I be 42 years old man, I don marry with four children and my wife na from Nigeria but for the twenty five years, I dey stay for obodo oyinbo, I never go my village go see my parents. The problem wey make me write this my story to obodo naija na because the problem dey very serious, na between life and death. I receive letter from my village say make I come see my parents and and any young man wey enter my village no dey come back alive because witches and wizard dey chop dem and all my senior brothers wey travel go village den no come back alive. I dey miss my parent make una advice me.
Posted on: Mon, 18 Nov 2013 10:01:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015