Omo na now person go dey do birthday and u go see dem gv small - TopicsExpress



          

Omo na now person go dey do birthday and u go see dem gv small pikin a plate of rice and 1 bottle of coke.for my tym wey i still b small pikin,omo wu wan gv u 1 bottle,na ur birthday wey u go drink one bottle only u,abi u dey craze.and dat tym d celebrant mama go come dey count.she go say oya 1,2,3,4,5,oya u join dem,eehe 6,oya share dis one bottle of fanta.and u knw say dat fanta dey get line line for body.so if u drink one line u go gv d nxt person make dat one drink.
Posted on: Mon, 25 Nov 2013 11:50:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015