P.M News/Updates. Report fly enter our studio through d window - TopicsExpress



          

P.M News/Updates. Report fly enter our studio through d window wey dey our Kitchen say Oga Emmanuel Uduaghan and my Number 1 Chairman Otuama dey burst Moet for my backyard,also as i dey talk so,Julius Egbedi and Monday Igbuya dey Igbuya Papa House dey celebrate PDP victory over DPP wey Supreme Court decide today. Army tanda for Ugbeyiyi junction dey control Traffic dis afternoon. Becos say na Army na so everybody couple deir sef as dem dey maintain deir self. Laff wan kpuff myself for d way people couple. Na from our studio wen dey back of Kpesa broda barbing Saloon wen dey Abeke Road nai we take dey call on OGUDE wen dey work for PHCN to helep d area pipo wen dat Transformer wen dey Owumi Junction dey serve. D neutral line of dat Transformer cut since and unu just leave am like dat. Make unu try helep d area pipo as we give unu 48 hours to fix d problem. Late Agbari Akpoisi House dey receive painting and renovation again from Family members. We don observe say dem don do dis kain renovation many times and Nobody dey gree dey take d apartment. Make unu lease d place give Bank. Traffic Jam for Sapele/Warri Road today na die as the queue for Okirigwe long reach Jesse. Na so Okoloko Bridge dey shake like old woman. Make unu quik attend to dat bridge oh,before e go cos avoke for d town. Also make unu caution all those Army say make dem dey use conscience take dey observe the queue wey lead to the Bridge and for dat reason make dem dey free the line to move on time. The queue for Amukpe Road na as a result of Speed Braker wey Army dey put for deir front. Na so my Barrister Ese Gam Owe and him Driver dey Trek wit deir luggage,as dem park deir motor for Road, all na becos of Army Speed Braker wahala. Lima Baby Shop and d one wen near her, wen dey Okpe Rd for d upstire wen harbour Tunde Butik, make unu nor dey shade unu baby tins dey enter Rd. D way unu use plastic and different baby implements take 'terusu' near Rd, e nor gud. Abeg make unu adjust. We dey sad to annouce d death of one Pa. Davidson C. N. Nwokafor wen dey stay no. 8 Omene Rd. Off Okpe rd. D man sick and dem admit am 4 New Jesus Heal Clinic for 3 weeks b4 dem come transfer am to Westend Hospital wen dey Airport Rd. Warri 4 one week, dem come re-transfer am to UNTH (University of Nigeria Teaching Hospital) Enugu State and na dere d man 4 come sieze breething (DIE) on Monday 17th June. We commiserate with d family most especially one of our facebook friends, Kingsley Nwokafor. Omeze wen dey 4 ubarn area opposite Owin compound 4 Laboard road, dat is d father of Shagari wen get caba still don 'kweme'. D man died some days back. May Their soul rest in Peace Amen. Some days back i post about vacancy for PHCN and i cum put Phone Number,abeg make unu nor respond to dat fool wey wan eat crowd money,as e dey instruct people to go pay N20,000 for e account to get d work. Johnbrain Global Resources limited, one new building material depot wen dem go open soon for that new structure wen dey after ogbodu estate wen dem build in the form of huts before Sapele Clinic, don donate 3 Electric poles to PHCN to help suspend the dropping cables wen dey front of the site. So, make d general public take note now before PHCN staffs go say na them go do am on their own or cum dey use am dey extract money again from people around dere. Oga Joseph Asheiyinku i dey wish you safe journey as u dey travel go brazil for 2 weeks say u dey go watch football. All dis ur carry waka,i don dey suspect you,but make we wait,becos if breeze blow fowl yatch must open. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 21 Jun 2013 18:23:32 +0000

Trending Topics



IONS AVAILABLE NOW... Serious inquiries please. SIGN
JUST COMPARE SAUDI WITH PAKISTAN AND YOU WILL FIND HAFIZ SAEEDS
Hey everyone! So this coming Friday we have ball hockey in the gym
Do we need to VOTE for these stupid Politicians who Block the

Recently Viewed Topics




© 2015