P.m News/Updates. 06/10/2014. Report enter studio say rate - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 06/10/2014. Report enter studio say rate wey Keke take dey increase for our Roads for Sapele dey very good,as the trekings don dey reduce. Also we don see many old kpafuka Taxi wen don die and dem don park up since,as many of them don bounce enter the Road dey hussle since dem ban dis Okada and Bikes for Sapele. We dey use dis medium dey beg all Keke and Taxi drivers say make dem dey park well before dem drop or pick passengers. The Traffic wey some of unu dey cause don dey de alarming. Report enter studio say the Camera wey pick the issue of Oshema Olololo Mabiaku cum send enter studio say the issue of that day wen we post say Omasan wife drink JIK,the intel report come say na Omasan House Girl nai get gbege with Omasan wife wey dem dey call Oritsema and na during the gbede nai the House Girl go drink JIK due to say,she wan kill herself and na dere dem for rush the Girl put for motor commot. Due to say the place dark,the shape and size of the House Girl come resemble the wife own,wey make us report am say na Oshema nai we see. This issue don dey cause kasala for d bunk since and the Girl don go beg Omasan wife after she recover from the personer suicide wey she put hersef. Report enter studio today say the family of Late George Scerri do service for am today for St. Patricks Catholic Church Sapele. The Burial service gada many Pastors wey come celebrate the service. The oyibo children nor show face but Mrs Phina Scerri children just dress on black suite like say d man nor die keep. The service start around pass 10 OClock for morning and after d service dem come announce say no Interment becos na foreigner,so dem distribute packs of TAKE-AWAY to interested collectors. Tennison wey be teacher wey buy old XETRA JEEP just dey use e car syrine dey disturb the service,for where better cars and my keke park put. Hon Austine Ayemidejor,Desopadec State Chairman Engr Kogho,Mr and Mrs Aldore Mogan,Great Makolomu,Hon. G Atose and host of others too numerous to mention nai attend the burial. The people wey dem order to distribute the packs just dey look face dey give people as some of dem carry up to 5 go deir Cars. Report enter studio say the Anti Crime Police Hilux wey one Benin Police officer wey tall and leg dey pain am,due to say some boys injure am break e legs,wey dem dey call Inspector Ighodaro don dey over dey cause road blocks for anyhow spots within the town dey extort money from car owners. This sad issue come up again dis afternoon,as dem even catch one Local Government Council driver wey don work with Igbuya,Enita and Hon. Godwin Atose,wey dem dey call Solomon and na Audi e dey use. Oga Police if u nor stop dis indiscriminate road blocks i go petition you and your team soon. Our studio camera wey dey on top Eternit capture Chief Charles Ufuoma Obule a.k.a Ekpa Igho dis evening as he dey blow with he white range rover and naso he convoy of mopol with siren juss dey blow dey follow am along Ajogodo Rd. Naso he just dey smile vien vien dey drive himself by himself in a peaceful manner. Oga our studio troway greetinz give u. Report reach us say police go arrest one kind illegal arrest dis evening for Jakpor Rd. Wey our studio try to access d cause of the arresting, we con find out say na base on very little issue wey nor warrant police arrest. Our studio still dey investigate d mata. Also, we dey call on NPF ASABA to release d wife of dat owisusu man wey kill Mr. Ayomanor since d man don submit heself. As d culprit don show face so, make unu release d wife. D man fit die for jail, he nor concern me, make he pay 4 he sins, but make unu release d wife. Sapele Tafia don waka round Sapele and we don see say this Keke issue nor be bad idea but e come at the wrong time. We all for studio stand for Amukpe Roundabout dey throway INTERNATIONAL KEKE APPEAL to any good samaritan to donate Keke to dis forum to savage the Transportation problem for Sapele and also to support the Okada owners wey dey dis forum,wen nor fit buy Keke due to the high rate of the Keke prize. WE DEY BEG. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 06 Oct 2014 19:29:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015