P.m News/Updates. 09/07/14. Report reach us say Medical - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 09/07/14. Report reach us say Medical Doctors wey go on strike since nation wide go soon call off d industrial action as d Nigeria Medical Association (NMA) don dey thrash out issues to make sure say Govt meet their demands b4 d start of ness week. Meanwhile, many Private hospital for Sapele full jam with pipo wey dey sick bed as Govt Hospital dey on strike. Wey our man around town visit many private hospitals for d town, we con see say bed nor dey reach patients again as some doctors dey go give pipo house treatment. Report reach studio say one Okotie-Eboh son wen dem dey call Fine boy Okotie Eboh wen dey stay Okotie Eboh house for Ogorode,the house name na Omimi Villa. This guy wife name na Clara & na Benin woman.This woman don shocken d guy,na him dey tell Fine boy what to do. When BEDC take light as dem pump water finish, dis woman on gen, only dem nai go get water, other tenant go trek go Flour Mill go fetch water. Wetin pain me pass one woman wen her belle don reach to push, go fetch water yesterday night around 8pm nai she fall for the gate of d compound. Make unu call dis guy to order befor e go craze follow woman enter pit. Report enter studio say Uzodinma Opara wey be 1 of the manager for BIOMED Lab dey do anyhow,as Mrs Omorogbe wey dey over try, go buy food stuff for the Director wife, and also she dey helep d Director wife dey clean House and she don dey with dem for like 6years. Dis manager just come join the Lab dis December wen pass so, wen dem pack go Ogoro bar junction e just dey put enemity b/w she and d Director/Wife. The provision store wen dem open na d woman dey go buy the things, even wen she suppose close by 3:30pm, because of market she go go houx by 6p.m, d manager just dey disturb am say anytym she cum from market make she bring receipt of wetin she buy for d store and she dey give am, but on monday before she cum 6:30p.m and she get husband & children, she con tell am say d next day. This woman con even tell d Madam say e be lyk say she go stop d market because d manager dey do am lyk say she dey thief, d same Manager kon tell am say make she nor go the market again she say no problem. Dem con tell d Sales Girl yesterday say make she dey go d market, d Girls cum say dat one nor join deir work,say dem nor go fit nai he sack 1 of d Girls, nai d other Sales Girl resign. This yeye Opara cum give d innocent woman suspension letter. Director of BIOMED na dis pipo wen u dey treat anyhow so nai helep you gada money wey u use take build dat ur Plaza nor abuse dem thru ur manager becos say u don dey see change now. Report enter studio say Emperormundi Kenneth wey be our friend for dis forum offend he Girlfriend Ejiro and he throway special appeal,as he two legs dey ground so dey beg Ejiro say e nor go offend her again and e promise to change from all d things wey Ejiro nor like about am. We for studio also join Emperor beg Ejiro becos na peace we all want. Na Orume Ejairu wey dey stay Oleh Rd nai be d latest aproko woman for Ebenezer Baptist Church as report reach us say dis woman dey judge both Rev. Ajagbe and oda elders for d church just to gain selfish favour. Orume Ejairu, respect ursef. Nor dey cos confusion for God houx b4 God go slap u frm heaven. *Special Notice ALL ENTERTAINERS FORUM PRESENTS A CANDLE LIGHT PRECESSION/TRIBUTE CONCERT FOR OUR OWN LATE KEFEE DON MOMOH AKA [BRANAMA] TAGGED- AN AMAZON HAS FALLEN. Featuring- Dance, Music, Comedy,Tribute, play let, music @ his peak, Maximum security is guarantee Date: Na 2mrw Thursday 10th july 2014. Venue: Na Labelle Event Center, Time 2pm 4 d candle light procession, [wey we dey call town rally]. D main event na 6pm till mama call. For more info and sponsorship pls call. 08064370863, 08030936576. Dis event is Powered by High Chief HON. CHIEF P.D.O AKPEKI. The Ugo of Okpe Kingdom... Na G8 nai package dis event.
Posted on: Wed, 09 Jul 2014 20:44:35 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015