P.m News/Updates. 28/09/2014. Report enter studio today say - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 28/09/2014. Report enter studio today say Catholic Church wen dey Yoruba Road don dey fine due to the preparation of Late Aziza burial wey dey come up,as the family don agree to use the Church take do VIGIL OF PRAYERS. Some members of the Church don dey vex say the Church dey do Waiyo becos dem nor suppose helep bury man wey marry more than one wife but money don dey talk as we say.Shits Happens. Them don dey paint the entire church again. Also report cum from Lady Faustina say the church do Harvest today and e dey matured. Report enter studio say one Lady wen dey sell food for back of them Ogharadoro do her pikin Party today for Abeke Road. The DJ try well well but na only one Canopy nai dem rent and the area pipo just dey dance like say dem norva witness Party once.The woman try shaa. Report enter studio say Sizzlers Food joint lack customers today. When we try interview some workers dem just dey vex say things dey go slow becos the management prizes too cost,compare to Foodland wey be deir rival. The business today for Sizzlers be like dry land as d guys wey dey enter the place just dey pay for guys and dem dey sip Minerals and meatpie. That eternit junior staff club wen dey beside abibna back of zenith bank suppose be d bomb but i nor understand wetin d management dey do. Wen I Stroll enta der dis evening, d place b like were dem for dey do obito.....Dat place suppose be pass d way we dey look am...D projector wen dem dey show captivate me pass cinema, as d tin clear pass video. Na only for dier reception wen be like big parlor nai some people wen nor know wats up just siddon...I for like stay watch dier clear projector but my wife call me say she dey feel some kind pain wen be like labor pain, nai I run comot dere Report enter studio say Richard Continental Hotel tight dis evening becos na LIFE band dey play but i dey use dis update dey call on Richard himself to stop Little Tony make e nor dey enter the place again becos Little Tony nor dey baff well and e nor dress well. The Richard Continental gada Soldiers full body due to say dem dey fear Boys wey dey do anyhow and make yangayanga noise. Report reach us for Studio Galloway wen buy RANGE ROVER last for Sapele don dey use e RANGE ROVER hse dey cause Traffic for Ugbeyiyi Road becos say men wen get pass am for the neighbourhood nor dey show themselves for d hood. Galloway don learn how to squeeze face like who lick piss. Galloway change before i tear u elbow. Report reach us for studio say na only one Medical Doctor nai dey the full General Hospital dis night as the families of one Girl wey rush deir pikin come the Hospital almost die with tears as deir pikin dey die for deir hand,why the Doctor wey manage dey just dey stroll like who nor plug phone. General Hospital make unu wise oh. Report enter studio say the new Hotel wey be standard NIGHT CLUB for Sapele wen dey number 2 Kings Street do some indoor maintenance as dem paint some portion of the Hotel for inside. The place make brain but dem nor sell Drinks today. I dey use dis update to invite unu to come the opening ceremony of the place on the first of October by 4p.m. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 28 Sep 2014 20:55:58 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015