P.m News/Updates. 29/05/2014. Report use NEW JESUS HEALS - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 29/05/2014. Report use NEW JESUS HEALS CLINIC enta studio say the Presidential Broadcast wey our Oga Goodluck Jonathan Gcfr, President of the Federal Republic of Nigeria, give today to mark the Democracy Day, make sense well, well. As different quarters of the country don dey call on all Citizens to embrace peace and work with our President on how to fight this Boko Haram insurgency on how to bring back our girls from Sambisa Forest. In anoda development, d microphone wey dem use take dey address pipo today for Eagle Square for dis year Democracy Day, con go off for almost 30 mins as d DJ claim say na system collapse. Dat na National Disgrace sha, but all d same, we use our studio wey dey bottom of Dame Patience Jonathan bed, take greet all Nigerians HAPPY DEMO-CRACY DAY Report use NEW SALVATION CLINIC enter studio today say almost all the Politicians wey dey Sapele throway indoor party for deir kaban to mark the Democracy day of hyper stealing to deir personal pocket. Na Hon. Julius Egbedi nai host e members of cabinet on code. Report use ST. JAMES CLINIC enter studio say Jerome Ezoba wey sell e only achievement Benz wey him and e family dey manage throway, as e use d money take go try one club screening for India but as we dey talk so the signing nor get head at all. Na Okada nai Jerome dey use dey parrabulet d town now and e set of twins dey squeeze face whenever dem see deir Papa. Report use TRASUREHOOD HOSPITAL enter studio say Bemigo wey dey work follow Ebosa company don dey tin finish as e eyes don dey big come out like frog own. Dis young man don dey buzubuzu dey go Beer parlours dey go hussle free drinks and e suppose dey pity e self for d multiple carry do wen e dey do follow Sapele when ever e cum Sapele from work. Bemigo na one person wey get Oil work then but Truck man dress pass am. Na mendi i wan use give Bemigo work for kpe-kpe-kpe make e go dey hawk fish. Report use OKPARAVERO MEMORIAL HOSPITAL take enter studio today say na stinky VICTOR OGHENE wey be dull Bachelor nai dey helep Omasan Olololo dey hide dey do some damage against him matrimonial vow. Na when e see hot Girls wey e like doke and e nor get bar to carry dem, e go come call Omasan the Jay-Z of Sapele to come carry one of d Girls so dat Omasan go pay for am and lodge am for Hotel. All dis na becos say Victor norva marry and becos of free kpekus wey e dey suck marriage don commot from e dictionary. Omasan stop to dey hang out with unmarried men becos you be still leader too and nor dey use ur new swiming pool dey toast Girls as u don send am give almost 19 different Girls from ur BBM. Christabel Eyabevwe throway report of appreciation thru LIBERAL CLINIC enta studio as she use dis meduim to say a big thank u to Nosa Ogbomo, Tripple Chiar Tony Adeniran and to everyone wey dey dis great forum say may Jah in his infinite mercy protect and continue to provide for unu. Amen. A big tnk u to all who inspire me in dis forum if not for u guys i for nor dey here today. Pls she say she appreciate. The exams wey unu enrol for her nai she dey thank unu put oh. Report use AKWARA HOSPITAL enta studio say hunger for GH don convert men destiny to Arm Robbers as Young Tailor wen pipo known as Harrison when go Ghana since he go thief he guy money, the money when e thief na 50,000 Thousand Ghana Cedis, wey be about 500,000k for 9ja money and the guy give am money make he take go buy laptop because e nor come Ghana with laptop, the money when the guy give am na about 50,000 thousand for 9ja money the guy name na Peter, the guy na Fela Red guy, the Peter dey stay Ugberikoko Rd before Borrow pit, e wife name na Shola. Harrison, wen u dey Nigeria u nor thief oh. See wetin fast money don put you. Report use SAPELE CLINIC take enta studio today say na Auntie Azuks Schools Uruakpa, Sapele nai do Marathon Race follow Sapele today as d students and pupils begin run like nama nama wey cut rope for slaughter. I gbadun d stlye as d tin dey cordinated with d presence of two ambulance and Road Safety officials wey dey follow up to maintain traffik. Dis na historic event wey Sapele witness today as na dis school nai be d first school to organize such sport event for Sapele. Make unu clap for dem. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 29 May 2014 19:22:44 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015