P.m News/Updates. 29/09/2014. Today all Sapele Tafia forum - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 29/09/2014. Today all Sapele Tafia forum member for Sapele stand for ground dey throway endless salute for all IGBOs wey dey Sapele becos the town make winnnnn wen all Igbo people close deir shops to honour the IGBO DAY. Today we recognise Chief Titus Nzewunze as the main Chief wey worth deir National Honour. Also we salute the entire groups for deir wonderful support today. Report enter studio say..Hon. Godwin Atose the Ex Local Government Chairman of Sapele Township. This local Govt nor get records of past glory but Atose dey beg all of is here to vote to am. As we all dey so we don tire for e new destroying attitude and we ready to quite them also. Report enter studio say the peopl wen go use gun take go kill Dog. As we still dey talk so some Girls enter,studio half naked. I cum dey wonder why the women nor dey well. We al for.studio throway greetings give the organizers. Report fly enta studio say the double parking wey pipo dey park for Ogodo Rd by Hausa Rd dey make am dey, dey difficult for cars wey dey ply dat road to dey pass dat place as d tin dey affect badaly. We dey call on the relevant authorities to go put measures in place make dos double parking for be a tin of pass. We dey draw ear dey give all mothers wey dey send their children dey go hawking dis period say make dem take care as report just land our studio say dem almost use one girl wey dey hawk potato take do rituals. D man carry d girl enta motor say he wan go pay d girl money for houx, e be like say d girl head nor get currency signal, nai d man push her commot from d car, zoom off. Make unu get sense. More News 2mrw. GOD BLESS SAPELE SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 29 Sep 2014 19:50:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015