P.m News/Updates. 31/12/2014. Report enter studio say Hon. - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 31/12/2014. Report enter studio say Hon. Micheal Diden a.k.a Ejele go attend one kain meeting for Omatseye Pikin House dis afternoon due to some political issues. After the meeting our studio catch Diden Ejele use ordinary legs waka come out from the House dey go House. Our CCTV see Hon. Winor Kelvin wen e drive wan go carry oga Ejele but Oga Ejele nor gree enter any of the cars including d one wen Winor Kelvin use. Ejele hope say u dey o.k becos dis na Watch-Night to New Year oh. Report enter studio say one useless Keke wey carry passengers use e debono take go jam motor wen park e own for Abeke Road and the Girl wen dey back of the Keke break her legs. Na about 4 people nai dedemu carry the Girl for another Keke so that dem go take her to Hospital. Report enter studio say one Driver wen dey use one Passat, wan park for Otite Road use e own hand take fall for the dish wey dey the road. As we dey talk so the Passat still dey d pit and we dey use dis update dey call on everybody wen go use that Route to dey careful. Report enter studio say Ireto Road people don finally use deir hand put Giant Speedbreaker for the entrance of Ireto Road,due to the notorious speed wen drunkards from RICHARD CONTINENTAL HOTEL take dey negotiate the curve. Na over cheap drink from T.M nai dey cause all those speed and we dey call on the Ireto Road DLA to put sign for the road,before and after the speedbreaker to caution drivers wey nor know say speedbreaker dey d road,make dem for nor run enter am with high speed. Report enter studio say one woman of 67years lost her life for Ugberikoko road dis morning after small illness. The woman children just abandon the woman for House due to say she nor train dem go School wen dem small. Na General Hospital dem be rush the woman go but as nurses dey on strike nai dem decide to rush her go Private Hospital before she die along the road. Report enter studio say Shell Road Carnival don set at the moment,as DJ Kess don dey throway vibes to ginger the area people. Paul Obi don dey drink since afternoon,why Prince Sajere don spout down to rock the gbedu. Report also enter studio say Oghene Road Carnival don also set for front of FIRE SERVICE. The area people don dey witness foreign jams,why the Dakar joint dey boom with turn-turn for throat. Make unu take life easy oh. Report enter studio say na combine squad of Army and Mopol nai dey parabulate dey golo round Ugbeyiyi area dis evening against any miscrants wey go shoot nock out around and to also hold thiefy thiefy jankolinko,wey go say e nor wan work but e wan chop. Make unu wen get mind to thief repent. We all for studio sympathies with anybody wen still remain for any of the Prison or Cell within Sapele to enter the New Year for dat kain place. Make God bless unu for there with peace. Report don too land our studio say dat gas plant wey dey near Rainoil don too dey do magogo as dem dey put both air for gas wey dem dey fill. Dem nor dey fill d actual KG for pipo. Make unu adjust b4 I rustigate unu. Our studio man around town don waka round all the town today to go inspect all the Hotels,Beer Parlours and Inn. She notice say all the Hotels freezer filled up with drinks and meat dem bend shele for showglass but people norva dey on ground to begin patronize dem. But when she reach Churches she cum see almost all major Beerparlours die hard customers for churches dey galivant,dey struggle to enter New Year for God House,then after God House dem go cum go resume drinking. Wetin cum be d need to go Church if the carry-do go continue? God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Goodbye to 2014 & Happy New Year.
Posted on: Wed, 31 Dec 2014 21:32:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015