PIDGIN MEDIA!! Una good afternoon & happy Sunday .... hmmm - TopicsExpress



          

PIDGIN MEDIA!! Una good afternoon & happy Sunday .... hmmm Today informate , nah from Burkina Faso I bring am come My lodge people no be small things ohh , The president of Burkina way him name be Blaise Campaoré no be small person, imagine the guy been they rule before them born me (1987) till now The people of this country don try do everything to make the man comot but he no gree ... they use juju , use bomb use use differen differen things but the man still full ground.. . So my people unto say nah the area way I dey so & as Nigerian way no dey carry last abeg make una tell me how I go fit remove that bros from the Presidential Sit .. So this people go respect Nigeria well well
Posted on: Sun, 26 Oct 2014 16:48:55 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015