PM News/Updates. 30/4/14 WORKERS ALL OVA NIGERIA GO OBSERVE - TopicsExpress



          

PM News/Updates. 30/4/14 WORKERS ALL OVA NIGERIA GO OBSERVE WORKERS DAY 2MRW WEN BE MAY 1ST AS FG DON DECLARE 2MRW AS PUBLIC HOLIDAY. WE WISH ALL WORKERS HAPPY RELAXATION. Report cum from Tafia Ologboshere wey dey Mission Rd axis say Seplat bring 8 survailance Chances come Mission Rd for Ayeitan Oil well discovery as Omolubi take 2 chances, the LandLords take 2, the youths wey dey gada dey hold meeting day and night take 2 and the Aiyetan Church take 2. As the benefit don dey come so,i nor wan hear say unu fight put one day. Report run enter studio with plantain leaf say Esther wey dey use one Red car wey dey under Hon. Micheal Diden payroll wey almost fall Victor Oghene trap, as Victor almost deceive her marry with fake engagement ring wey he give the Esther. Dis same Esther don dey use one of her old fire wood wey dem dey call Kafari. Kafari don bury for Esther kponyon after she use Kafari kneel down as d guy come back come take e usual place wey Victor Oghene wey do face like cobra seize since wit mendi. Esther u nor wan rest abi? Make e dey sweet you as u dey work for ZARTECH dey collect money from Songhaii. Report just reach me now say dem don disengage all BEDC workers wey dey manage dey work for field. So 4 d nw BEDC nor get any worker, depend on wen dem go engage dem again, many of dem don go collet dia disengagement latter. Dis thing happen late yesterday and nai make most Transformers wey dey faulty so nor receive any meaningful attention. Report reach our studio say Ete Sagay wey dey work for Asaba don dey over dey drink follow Sapele like who nor get another work again. This bros don reach e menopause and e don use Beer take neutralize the spermatozion becos na total of 56 GP Tank of Achohol nai e don consume since 6 years back wey e hand cum dey hot like who dem put for Oven. We dey call on committee of friends to call Ete Sagay to order becos e nor get excuse not to reproduce becos e over flexing too high and e dey among wetin dey disturb am. Too much guy dey affect. Report use semeje take enter our studio say The Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) don slam the Deputy Speaker of the Delta State House of Assembly, Hon. Thief. Basil Ganagana, with 10 counts of allegedly defrauding the State Government. The Judge wen dey incharge of the case wen dem dey call Justice Mabel Omovie, don adjourned the matter to May 28th 2014. Dem charge Hon. Ganagana, with e wife, Joan Ganagana and e brother, Thaddeus Ganagana, for the case with number A/ICPC/1C/ 2014, as dem say he dey use he office to loot d state with corrupt advantage with he relatives, and dis offence dey punishable under Section 19 of the ICPC Act 2000. Wen Tafia Okpubuluku view d list of charges, we con see say Hon.Ganagana nai nominate Thaddeus [for employment], wen lead to he engagement as he political aide under the name of Thaddeus Ekpo and dis Thaddeus na still an employee of the Delta State Ministry of Education (Basic and Secondary), which means, na two salaries nai dis Thaddeus dey recieve every month end from both organizations. Hon. Ganagana still retained he wife, Joan Amaebi Ganagana under one fake name, “Amaebi Okoro” as he Legal assistant while d wife still dey work with the Delta State Ministry of Justice, na still two salaries nai she dey recieve. Dem still charge d Deputy Speaker say he carry money by means of an act wen law dey call felony, and d tin dey contrary to Section 13 and punishable under Section 68 of ICPC Act, 2000. Graduates full streets dey suffer, only u sitdown press 50 job slots for d State. I wonder if unu norva pass back take employ pipo for d Civil Service Job. Who say na our sweat and state money nai he wan thief, dat person go naked dance for public place. Report blow enter studio dis evening say WORWOWOR nai be one black tall woman wey dey sell hot pepper soup with wheelbarrow and for under the pot she dey put fire so dat d food go dey hot all d time,nai make dem dey call her worwowor. This woman dey sell round ward 5 &4 go reach market side. Her husband get stroke for 5yrs now but stroke just attack dis woman once nai she die. We regret to announce dis great lost as d tin affect almost all her customers including myself. Make her soul rest in peace. All Baptist for Nigeria. Dey hold their annual. Programme for Ibadan as I dey update so, the programme start since on Saturday (26/04!2014), big names for politics for Delta State dey the ground. Pipo like Hon. Chief M. O. Igbuya, Abiyemi Gabari etc even the President and some Governors dey the ground on Tuesday. We dey expect dem back dis weekend and we pray make God bring dem back safely. SECURITY ALERT- DAT KOLO WEN DEY RESIDE NEAR SAPELE MAIN STATION TOO NEAT TO BE KOLO. I DEY DRAW THE ATTENTION OF SECURITY OPEARTIVES TO PUT EYE FOR DAT KOLO BODY AS MY MIND DEY SUSPECT SOMETIN. GOD BLESS SAPELE SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 30 Apr 2014 19:57:11 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015