PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH1. The Lord na mai Shepherd, I dey - TopicsExpress



          

PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH1. The Lord na mai Shepherd, I dey kampKe2. He make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi Thermacool.3. He panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness for sake of Hin Name.4. Walahi! If I waka pass where arm robber,419, and juju people borku, come even joinokada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so them dey like back bone dey comfort me.5.You don prepare Banga and starch makeI chop. All my enemies dey look anyaya. You rob me for head wit Vaseline IntensiveLotion. My cup na Ogunpa River wey comeoverflow hin bank.6. True, true, betta life & mercy go gum my back till I quench. And man go tanda for God house sotey sotey from Lai lai to lai lai. GOD ALMIGHTY, NA YOU BIKO. AMIN!!
Posted on: Sun, 16 Jun 2013 16:20:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015