PSALMS 23 IN PIDGIN ENGLISH. 1 The lord na my shepard. I dey - TopicsExpress



          

PSALMS 23 IN PIDGIN ENGLISH. 1 The lord na my shepard. I dey kampe. 2. E make me sidon for where better dey flow and come put me next to stream make my body thermacool. 3. E panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness, because of hin name. 4. Walai!!! If i waka pass where arm robbers, 419, and juju people boku, come even join boko haram, reach valley of the shadow of death sef, liver no go fail me. Your rod and staff nko?? Na so dem dey like backbone dey comfort me. 5. You don arrange good food on top table make i chop. See as bad belle people dey look waa waa, You rub me for head with vaseline and intensive lotion, my cup come be like RIVER NIGER dey troway dey go. 6. True, true, better life and mercy go dey follow me till i quench. And i go tanda gidigba for the house of CHINEKE from lai lai to lai lai, God Almighty. Na you biko AMEN.
Posted on: Tue, 02 Jul 2013 11:17:19 +0000

Trending Topics



v class="sttext" style="margin-left:0px; min-height:30px;"> 200 pesos/$5 may online negosyo kana ✔50% Affiliate
Saying Happy Birthday to my M! My rollie…my homie….my magunny.
Two Russian strategic bombers conducted practice cruise missile
A sidewinder rattlesnake climbing on loose sand. The videos
For my sister Alysia Smith..hey love the world belongs to

Recently Viewed Topics




© 2015