. Papa God na mai Shepherd, I no di lack. . Yi make me sidon for - TopicsExpress



          

. Papa God na mai Shepherd, I no di lack. . Yi make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi Thermacool. . He panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness for sake of Yi Name. . Walahi! If I waka pass where arm robber, 419, and juju people borku, come even join okada reach valley of the shadow of dei sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so them dey like back bone dey comfort me. .You don prepare Banga and starch make I chop. All my enemies dey look anyaya. You rob me for head wit Vaseline Intensive Lotion. My cup na Wouri River wey come overflow yi bank. True, true, betta life & mercy go gum my back till I quench. And man go stanap for God house sotey sotey from Lai lai to lai lai.
Posted on: Mon, 17 Jun 2013 14:35:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015