Pickin by Lara Allan-Balogun 2010 Me dey hungry Me dey skinny Me - TopicsExpress



          

Pickin by Lara Allan-Balogun 2010 Me dey hungry Me dey skinny Me look, me look, me look, me no find food chop Me dey hungry Me dey skinny E b like say I dey die.. D wicked d fly master Everytime e dey come to dey pollute d food Me belle e dey pain me every time I eat am I stop Me take me d eye look up Me say me Daddy I dey hungry o ..no let me die He send me d manna He send me d sparrow bring me d seed He send me d good aunty and d good uncle Dem help me plant d garden Ah I don chop again E be like say dem pour fresh water for me body Me body dey cool eh like so I no die again D friend of me e come visit me E tell me say I dey look rosy O Me dey blush for inside me brown skin ae Me dey smile say na me Daddy O Me Daddy no leave me Even E send me d sparrow and make d manna to fall But E tell me say me must to water d seed wey d sparrow give me Me must to no keep d manna make e stale But me go wait Him give me d fresh manna every day Me must to bring meself come d place wey Him go put d fresh manna every day Me must to plant d garden & dress am Me must to remove all dem weed dem even d one wey I like d colour Some dem weed dem fine ae! Like flower decorate d garden But Daddy say weed na weed Daddy say add d fertilizer every day, gather d seed wey scatter for d road and drive all d birds dem commot wey wan steal d seed So d garden go grow, make e dey gimme plenty plenty d fruit Dis wey me Daddy tell me Even though me Daddy don go for d distant land....far far away Me still dey hear Him voice Him voice na like d cool evening breeze after d hot Saro sun don finish hammer me Me Daddy - Him Spirit no leave me
Posted on: Sun, 08 Sep 2013 15:20:34 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015