Plenti fans for London don dey jolly as tori enta say Jose - TopicsExpress



          

Plenti fans for London don dey jolly as tori enta say Jose Mourinho go come back Stamford Bridge take de Chelsea work. True true sf, de tori don confam say Chelsea don appoint Jose Mourinho as dia manaja for de secon time, de Premier League club don anounse on Monday. Afta all the olofofo tok and gist wey just dey circulate for de pass weeks so, de 50 years Portugal coachi don sign ogbonge four years kontrak . De coachi wey coach Chelsea from 2004 reach 2007 dey jolly say hin don come back to de place wey hin like. "I dey jolly say Jose dey show, come bak again to Chelsea. De way hin dey do, dey win, don make am de de oga wey we nid for de work," Chelsea chief executive Ron Gourlay tok for statement wey dem publish for Chelsea website. "Na our parade to dey go front make we runs tins, win big, dey successful for front and Jose na de ogbonge numba one choice wey dey our mind, and we sef bilif say na him be de best manaja wey fit do wetin we want.
Posted on: Mon, 03 Jun 2013 17:44:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015