READ DIS AND MAKE YOU SHARE AM Dis 1 dey happen for 1963 wen Naija - TopicsExpress



          

READ DIS AND MAKE YOU SHARE AM Dis 1 dey happen for 1963 wen Naija first and d only Prime Minister Sir Abubakar Tafawa Balewa take him annual leave say make him go rest small and straight na him village him go do d holiday. Wen Tafawa Balewa don go 4 holiday finish na him 1 oyinbo photo journalist wey bi say come from British 2 look 4 him and dem come tell d oyinbo man say d PM don go 4 holiday. Na him d photo journalist come dey ask dem say na wich contri him travel go 4 d holiday but him come dey surprise wen dem tell am say d PM dey him village wey him dey do d holiday but d photo journalist wan dey sure na him come make am say make him kuku go see d PM 4 him village but wen d photo journalist reach d PM village him no see any sign say big man dey dat village everybodi jus dey do dem own things normal normal and d village come dey 2 quiet. D photo journalist come see 1 farmer wey dey come wit him donkey wey carry sugarcane him come stop d farmer and ask say na d PM house him dey look 4 d photo journalist no fit talk again wen d farmer tell am say him jus live d PM nau and d farmer come tell am say wen him reach d PM house him go see d PM wea him siddon 4 ground wit him pikins dem wen dem dey jolificate wit d sugarcane wey him give d PM na d farmer dey yarn dis after him don show d photo journalist d way 2 d PM house. D British photo journalist dey surprise wit wetin him see wen him reach d PM house. Dis na d foto wey him take dem. Our prayer nau bi say make suffer of we pass heroes no go in vain. Na wetin we dey see wit we eyes 2day na vagabonds and thieves wey dey power, barawo wey dey disturb d city wit sirens, people wey dey loot treasury of we nation and still dey insult we common intelligent wit dem embarrassing incompetence. Naija get everything wey bi say fit make am bi greatest Nation 4 dis earth, wetin we want 4 Naija nau bi visionary, dedicated and inspiring leaders no bi all dis shameless thieves wey bi say dem bi incorrigibly kleptomanic bandits wey dey lie, rob, cheat, rig and pai 2 get 2 power. Na dis 1 dey make me yarn say wen time 2 vote reach make we dey remember our pikins dem and d 1 wey bi say we neva born dem make we use we head 2 vote d right pesin.
Posted on: Mon, 30 Sep 2013 17:40:11 +0000

Trending Topics




© 2015