SALM 23!! PIDGIN ENGLISH Version 1. The Lord na mah papa, I - TopicsExpress



          

SALM 23!! PIDGIN ENGLISH Version 1. The Lord na mah papa, I dey kampe 2. He make me sit down for where beta dey organize come put me beside stream make mah body therma-cool. 3. Him over-panel-beat mah soul come spray am pure, come dey lead me dey go through express road of righteousness for sake of Him Name. 4. Walahiiii! If I waka pass where arm robber, 419, and juju people borku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so them dey like back bone dey comfort me. 5.You don prepare Banga and starch make I chop. All my enemies dey look anyaya. You rob me for head wit Vaseline Intensive Lotion. My cup na Ogunpa River wey come overflow hin bank. 6. True, true, betta life & mercy go gum my back till I quench. And man go tanda for God house sotey sotey from Lai lai to lai lai. GOD ALMIGHTY, NA YOU BIKO!
Posted on: Sun, 16 Jun 2013 14:28:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015